Joy Nunieh, sacked MD of NDDC - Her testimony against Godswill Akpabio, Minister of Niger Delta before Nigeria lawmakers

Dr. Joi Nunieh house arrest

Wia dis foto come from, RVGH

Read am in 4 mins

Joy Nunieh, di sacked MD of Niger Delta Development Commission NDDC on Friday tell Nigeria lawmakers say di Minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio bin threaten to remove her from office if e no go swear one oath wit am for Uyo, sometin wey di Minister don already deny.

Former Acting Managing Director of NDDC wey address di House of Representatives Committee wey dey investigate NDDC through zoom video, say Senator Akpabio say dis oath taking na di only condition for two of dem to work togeda in peace.

Dr Nunieh call on Nigeria police to investigate oga Akpabio dis accuse because na crime under di Nigeria criminal code act for pesin to force or suggest make anoda pesin take oath.

She say if to say she take di oath, e for life risk imprisonment for di Minister of Niger Delta Affairs but since she no take di oath, na like five or seven years for di senator.

Joy Nunieh biography and GodswillAkpabio

Oda tins/acccuse wey Dr. Joy Nunieh sama today for di Public Hearing

Dr Joy Nunieh sama plenti-plenti accuse give di minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio during di hearing wey take place today.

See some of di accuse wey she sama;

  • She no change dollars wey belong to NDDC na afta her tenure dem change di dollar.
  • She say Senator Akapbio pressure her to sack some staffs of NDDC.
  • She spend N8bn during her tenure from Oct 2019 to Feb 2020.
  • She say files just dey miss immediately dem start di verification of contract exercise and she drop one memo make dem no take any file from di commission. She say she confront Mr Akpabio on top di files wey di EDP and EDF collect and Mr Akpabio admit say im don ask dem to return di files.
  • She say she be di most unpopular MD wey don eva come NDDC and wen dey remove her, Senator Akpabio personally send out video recording of di youths wey dey say; "make she go, make she go, she no gree give us money."
  • She say Senator Akpabio refuse make dey give her official vehicle because she no gree cooperate with am. She add say she sharperly return di two bullet proof cars wey she dey use afta she find out say dem come from contractors and wen she tell senator Akpbaio about her findings, e say no be big issue.
  • She say Senator Apkabio dey monitor her upandan, wia she go, who she visit or tok to.
  • Di problem wey national assembly dey investigate today get three major groups wey dey responsible for di tins wey don happun for NDDC, one group na di management(IMC), di second na di Staffs and di third na di pipo of Niger Delta.
  • She Senator Akpabio insist say im go supervise di forensic audit but she remind am and show am di letter wey di president don write on top dis investigation.
  • She say dem don deceive everybody for Nigeria say forensic audit dey go on for NDDC, but no forensic audit dey go on and she no pay any money for forensic audit.
  • She say Senator Akpabio tell her say she get 'poverty mentality' wen she refuse to do a lot of tins wey im ask her to do. She say she want her name to dey clean and no get any reason to look for bad money but Senator Akpabio tell her say di only condition for dem to work togeda na for her to go with am go take one oath for Uyo, if not e go remove her.
Joy Nunieh house arrest mata make her do zoom call from wia Ezen Nyesom Wike - Governor of Rivers State keep her wen she give testimony to di house committee.

Wia dis foto come from, OTHER

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dr Joy recommendation to di Committee for di way forward of NDDC

Afta all di tok-tok today, di committee come ak Dr Joy Nunieh to recommend give di committee di way forward for NDDC, dis na wetin she suggest;

  • She want di forensic audit to really take place. So make dem write to di auditor general for im to give dem di list of certified forensic auditors in Nigeria so dat dey go ft get dem quickly to carry out out proper forensic audit of di NDDC.
  • She want make president Buhari ask/direct di immediate establishment of di National procurement council because dis go help Nigeria save so much money in terms of fraud or corruption.
  • She say di National assembly get big role to play too, dem need to supervise di new management and make sure dem act only according to di law.

Meanwhile Nigeria House of Reps. Committee on NDDC don summon di minister of Niger Delta Affairs, Godswill Akpabio and di acting MD of NDDC Prof Kemebradikumo Daniel Pondei, to appear before dem 11 am on Monday to answer kwesion ondi corruption allegation against di dem and to make dia presentation and respond to queries against dem.