Gold mining: How PAGMI, Nigeria Presidential Artisanal Gold Mining Development Initiative go work and benefit you

File picture of gold bars

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Olubunmi Okunnu
    • Role, Broadcast Journalist

On Thursday 16 July, Nigeria president Muhammadu Buhari collect di first gold bar wey artisans produce according to international standards, to mark di launch of im Presidential Artisanal Gold Mining Development Initiative (PAGMI).

Di Nigeria goment say di 12.5kg gold bar - wey Central Bank of Nigeria (CBN) don buy - meet di London Bullion Market Association (LBMA) standard, wey mean say any one in di world fit buy am wit confidence.

But di benefit for any artisan wey dey mine gold be say, unlike before wey dem go dey find buyers, CBN go always dey available to buy am from dem at correct price.

Why dem setup PAGMI?

Nigeria say data from UN Comtrade show dem say from 2012-2018, 97 tonnes of gold wey worth over $3 billion na im pipo use mago-mago take smuggle comot di west African kontri.

On top dat one, illegal artisanal mining alias small backyard mining cause kata-kata for some gold mining communities. From 2010 to 2016, na more than 7,000 accident from lead poisoning cause 700 pipo to die for Zamfara and Kebbi alone for north west Nigeria.

So for 2019, president Buhari form PAGMI to wey go be formal association for artisan gold miners dem.

PAGMI na Gold mining programme in Nigeria

Wia dis foto come from, Anadolu Agency

Wetin we call dis foto, Many thousands of artisanal miners across Africa risk dia life to find gold

How e go work?

PAGMI guarantee say dem go buy all di gold wey artisan mine and produce through di National Gold Purchase Program.

Di programme go make sure say artisans get safe and correct modern machines to use.

PAGMI

Wia dis foto come from, PAGMI

Wetin be di benefit?

According to di goment:

  • Artisans and small-scale miners, rural mining communities, registered buying centres, investors, Central Bank of Nigeria (CBN) and Federal and State Governments go benefit
  • 500,000 new mining and formalized jobs go dey
  • Artisan miners nationwide go get national identity card - 20,000 miners don already register for Kebbi and Osun
  • Thermo Fisher Scientific and Mettler Toledo companies go install equipment to use in gold testing and to weigh dem

PAGMI go operate for states like Kebbi, Kaduna, Zamfara, Niger and Osun States although dem go first start wit Kebbi (north west) and Osun (south west).

Wetin we call dis Video, Gold mining inside Ghana: Di underground waka to look for gold with one child miner