Gold bars just dey rain comot airplane for Russia airport

Precious metal bars scattered across the runway at Yakutsk airport on 15 March

Wia dis foto come from, YAKUTIAMEDIA.RU

Wetin we call dis foto, The precious cargo rained down on the runway

E shock pipo as dey see gold dey rain down for one airport for east Russia.

One plane bin dey transport gold-silver alloy dey go when di container wey dem put am break, come make plenty gold rain down for di runway.

E reach like 200 gold bars wey scatter all over di runway of Yakutsk airport for Siberia.

Na one Canadian mining company get am and dem don talk say dem don gather all di gold wey scatter.

A metal bar on the tarmac at Yakutsk airport on 15 March

Wia dis foto come from, yakutiamedia.ru

Wetin we call dis foto, Each gold bar fit weigh 20kg

Police don launch investigation into di mata.

Police examine broken hatch on cargo plane

Wia dis foto come from, yakutiamedia.ru

Wetin we call dis foto, Police block di area