Nigeria Dana Air: Back door fall as plane dey land

plane dey fly for air

Wia dis foto come from, Dana Air

Read am in 1 mins

Katakata nearly happen as back door of Nigeria airline Dana Air plane wey carry passengers fall.

Di back door of di plane wey bin carry passengers bin dey shake through out di flight. Di door finally fall comot was di plane hit ground to do final landing.

One of di passengers Ola Orekunri, post for Twitter say, di kind noise wey e make throughout di flight make am fear. But im bin think say na "just di screw loose."

For June 2012, 153 passengers die for inside Dana plane crash wey happen for Lagos, Nigeria.

BBC Pidgin try talk to officials of Dana Air, but dem no respond di time wey we file dis report.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post