Coronavirus: Ghana observe national fasting and prayer today as covid-19 cases reach 53

Wia dis foto come from, Presidency Republic of Ghana
Ghanaians dey observe national day of fasting and prayer for protection against Coronavirus today.
Both Muslims and Christians dey join de fast wey Prez Akufo-Addo declare sake of de coronavirus pandemic.
During en televised broadcast, Prez Akufo-Addo talk say "I dey appeal to all Ghanaians, Christians den Muslims, say dem for observe national day of fasting and prayer."
"Make we pray to God so say he go protect wana country den save us from dis pandemic" he add.
Ghana Union of Traders Association (GUTA) also urge dema members say dem for lock up dema shops den join de national fast and prayer.
Anthony Oppong, Ashanti Regional Chairman of GUTA talk say "we decide to add wanna voice to encourage wanna members say make dem join. Also, make dem lock dema shops so say dem fit make time to pray to God."
Ghana close all air, land and sea borders sake of increasing Coronavirus infections wey people import into de country.
Tourism authorities don also close beaches till further notice as precautionary measures to contain di spread of di disease.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
However, Ghanaian citizens den foreign nationals who get residence permits go enter mandatory quarantine if dem arrive Ghana before Sunday midnight.
Dis move be part of ways wey go "limit den stop de importation of de virus, contain de spread, care for de sick well-well, reduce de impact of de virus on social den economic life den inspire de increase Ghana en domestic power den self-reliance" President Akufo-Addo talk.

Wia dis foto come from, Ministry of health, Ghana
He make dis announcement after Ghana record first covid-19 death case where one Lebanese who chop 61 years die for Kumasi.
Officials say de patient wey die get some other health conditions in addition to coronavirus.
Di authorities encourage di pipo make dem obey social distancing rules.
So far, de country record 53 infections, 2 deaths den no recoveries.











