Japan naked festival: Men wey no wear cloth hustle to catch 'lucky stick'

Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Thousands of men almost naked finish dey try dia luck to find two sacred sticks as part of ancient Japanese festival.

About 10,000 men wey na only small cloth dem use tie waist, follow do di ceremony for Kinryozan Saidaiji Buddhist temple for Okayama on Saturday.

Dem use water purify di men before dem begin struggle with each oda to find di sticks wey one temple priest throw for dia midst.

Dem believe say di pipo wey find di 20cm-long "shingi" sticks, no go lack good luck for di year.

Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di annual festival don dey happen for over 500 years
Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di men purify demsef inside cold water before di hunting of di stick begin

Di event dey begin inside di cold water of Yoshii river wia di men go enta in oda to purify demsef.

Den wen time reach, about 22:00, afta di purification stage don complete, dem go off di lights.

Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di cold water of di Yoshii river na wetin dey purify dem
Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di men wey come find di two sticks go be di ones wey go see good luck pass for di year, according to dia belief

Di temple chief priest go come stand by window wey dey four metres high and and throw two shingi into di crowd.

For like di next two hours, all di men go begin struggle to find di two sticks inside gbege wey, sometimes, pipo dey die inside.

Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Everybodi wey wan participate must tie cloth to cover private part
Saidaiji-eyo festival

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di event dey attract thousands wey just come to watch di men find di Shingi

Aside from luck wey shingi dey bring, na also fertility festival wey dem believe same go make farmers see good harvest for di rest of di year.