TICAD 2019: Wetin dey carri Buhari go Japan

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo
Nigeria on Sunday announce say presido Muhammadu Buhari fly comot from di kontri go Japan.
Di presido and some oda African leaders dey enta di city of Yokohama for di seventh edition of di Tokyo International Conference for African Development (TICAD) summit.
Dis TICAD dem don dey do am for Africa and Japan since 1993 and dis year own go start from Wednesday.
Di African leaders wey don confam say dem go show face na:
- Muhammadu Buhari, Nigeria
- Cyril Ramaphosa, South Africa
- Ibrahim Boubakar Keita, Mali
- Edgar Lungu, Zambia
- Macky Sall, Senegal
Tori be say di presido of Ghana, Nana Akufo-Addo dey enta Japan on Monday to attend di meeting.
Pipo wey join hand for di meeting na United Nations, di United Nations Development Programme, di World Bank, and di African Union Commission.
Dem go discuss Japan investment plans for Africa and how di continent go take benefit.
Although Japan investment for Africa reach $9 billion for 2017, e small compare to wetin anoda Asian kontri China don do. According to di United Nations, China don invest reach $43 billion as at 2017.
End of Di one wey oda users dey read well well











