Chioma Ikeaka-Uzodimma: Meet di youngest First Lady of a state for Nigeria

Wia dis foto come from, Other
- Author, Daniel Semeniworima
- Role, BBC Pidgin, Lagos
Chioma Ikeaka-Uzodinma na di new first lady of Imo state, South East Nigeria wey don break record as di youngest of dem all inside di kontri.
Di 30 year old Lawyer marri di Govnor Hope Uzodinma wen im be Senator wey dey rep Imo West Senatorial district (Orlu Zone) for 2015.
Mrs Chioma Uzodinma, wey go begin carri di tittle 'Her Execellency' na mama of three children, including twin.
Tori be say she dey beautiful, more vibrant, good looking and full of energy as a young lady.
She study Law for Imo State University wia she get Bachelor of Laws (LLB),
She become Barrister at Law from Nigerian Law School, Abuja.
Di 30 year old Barrister don be Junior Associate for Emeka Etiaba & Co law office, Intern for Rickey Tarfa $ co law office and for Chris Uche & co law office.
Na for Dority International Secondary School, Aba, she do her Secondary School education.
End of Di one wey oda users dey read well well
She bin live beta part of her early life for Aba, Abia State, South East Nigeria.

Wia dis foto come from, Chioma Ikeaka
Na she be di only girl among di pikins her mama and papa born - she get two brodas.
She from Ideato local goment area for Imo state.











