Sotitobire Church: Court say make Pastor Alfa dey prison for 21 days

Woli Alfa Babatunde

Wia dis foto come from, facebook/Okanlawon Olowu Idowu Henry

Court don judge say make di pastor of Sọtitobire Miracle Centre, Alfa Babatunde dey for prison for 21 days until further investigation on top im mata.

Di Magistrate Court for Oke-Eda, Akure, Ondo state capital, South West Nigeria, na im sama dis judgement and adjourn di case go 17 January wey dem go continue to torchlight am.

Pastor Alfa Babatunde afta judgement

Ondo State goment na im bin cari Pastor Alfa go court on Monday, December 23 on top accuse say im kidnap pikin.

Di pastor and four oda pipo na im face trial for court today.

Pastor Alfa Babatunde afta judgement

Last month, pikin bin miss for im church for wia di mama wey be member bin dey worship, dis mata come make I-no-go-gree pipo burn di church dey claim say dem see di bodi of di pikin wia dem bury am for di place.

Pipo dey wait Pastor Alfa Babatunde judgement

Although, police later say notin like dat.

Pastor Alfa Babatunde lawyer dey tok to tori pipo

Pastor Alfa dey face accuse say im join kidnap pikin plus accuse say im kidnap pikin.