Seven pikin die odas injure for Kenya school collapse

Wia dis foto come from, Reuters
Seven school children don die afta one classroom collapse for Kenya capital, Nairobi.
Police commander George Seda and di area member of parliament, John Kiarie, confam di death toll afta di structure for Precious Talent School collapse on Monday morning.
Tori be say di school wey dey made up of wood and corrugated iron sheet collapse minutes afta di start of di school day.
Goment tok tok pesin Cyrus Oguna say fifty-seven pupils don dey admitted for hospital for treatment.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di school manager, Moses Wainana Ndirangu, tell Kenya Citizen TV say di structure become weak sake of nearby suckaway wey dem dey construct.
Im say around 800 children na im dey attend di school, but na only 20 dem don fit account for as dem do emergency roll call afta di incident.
Oga Ndirangu still add say e fit be say most students run go Dagoretti neighbourhood afta di collapse happun.
Meanwhile, Kenya Red Cross don tweet say dem don set up informate desk to help parents and guardians trace pupils wey miss afta di incident.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2













