Sotitobire church: I-no-go-gree pipo don burn wia dem tiff pikin for Akure

Sọtitobirẹ church

Wia dis foto come from, Twitter/@horpizzle

Wetin we call dis foto, ̀
Read am in 1 mins

I-no-go-gree pipo don light fire burn Sotitobire miracle church for Ondo state, south west Nigeria, ontop accuse say dem discover di deadi bodi of one one-year-old pikin.

Na last month di pikin miss during church service, for wia di mama wey be member, bin dey worship.

Di mother of di pikin Modupe Kolawole bin don tell BBC say she suspect foul play, for di way her pikin take disappear. She bin tok say di church no dey helep di authorities with dia investigations.

BBC Yoruba reporter wey dey di scene no confam say dem find di body of pikin inside di church.

Police tok-tok pesin for Ondo state confam di incident say youths burn di church.

Pipo too don dey post video clips of how e happun.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Nigeria secret police arrest Alfa Babatunde, wey be di founder of di church last week in connection with the incident.