London Bridge: Two pipo die for di stabbing attack

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Two members of di public don die from di stabbing attack for London Bridge, police also shoot and kill di suspect.
Met Police don confam say dem dey treat di mata like say na terrorist attack.
Tori be say di suspect die for wia e happun and dem believe say im wear fake bomb cloth na wetin police tok.
Video for social media show as pipo for area dey hold di man down. E be like say as one officer show im tell di pipo to move before im shot im gun.
Metropolitan Police say dem call dem sake of one stabbing for di area near di bridge just before 14:00.
Dem say dem don detain one man. London Ambulance Service don declare am as "major incident

Wia dis foto come from, Reuters
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
BBC tori pesin John McManus, dey di area, im say im see one group of men dem wey dey fight ontop di bridge. Before Police show di area and im hear gunshots, na wetin im tok.
Police don advise pipo near di area to follow directions from officers wey dey ground.
End of Di one wey oda users dey read well well













