Minimum Wage: I ready to pay pass N30k as minimum wage - Sanwo-Olu

Babajide Sanwo-Olu carri microphone dey tok

Wia dis foto come from, Lagos State Govt.

Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu on Tuesday inside meeting wit labour union leaders, promise say Lagos go pay pass di N30,000 national minimum wage.

Sanwo-Olu bin follow leaders from di organised labour unions meet for wia im yan say Lagos State go begin pay when di federal goment and labour unions conclude dia tok-tok.

Di govnor say im wan pay pass N30,000 because im administration understand wetin workers for di state dey face day in, day out.

"E fit no plenti, but we go pay pass di N30,000 minimum wage.

We understand everibodi dey take big eye look Lagos and also wetin workers eyes dey see for Lagos. If oda states fit reach that amount, I believe Lagos need to show more to appreciate workers contribution to di growth of our State," tok Sanwo-Olu.

Babajide Sanwo-Olu wit labour union leaders for Lagos State

Wia dis foto come from, Alamy

Nigeria economy go fall if we pay new minimum wage - FG

Leaders of di Nigeria Labour Congress and goment representatives meet for hours for Labour Ministry to chook mouth on top how goment go pay di N30,000 minimum wage on Tuesday October 15, 2019. E no tay afta Nigeria goment agree to pay di minimum wage wey dem announce say na only workers for small grade level go get increase.Dis one bin vex labour leaders and dem come say dem go go strike on Wednesday 16 October.

Chris Ngige

Wia dis foto come from, Getty Images

So goment agree to follow dem do meeting to stop di strike.Minister of Labour, Chris Ngige tok for di meeting say if goment use all im moni pay workers, di economy go suffer and fall yakata like Venezuela own.Oga Ngige explain say di 2020 budget be N10.3 trillion and di total cost for personnel be N3.8 trillion without overhead and running cost wey be almost 76 percent of di budget and dat if goment pay all dat moni, how much go dey to build road and oda infrastructure for di kontri.Ngige tok dis one wen im meet wit di leadership of NULGE for im office. E explain say im surprise say NLC and TUC dey call for nationwide strike for different states wen dem neva meet and tok wit state goment dem.

"Make dem dialogue first before dem go call for strike!... If you use strike to try shake ground, dat one na intimidation according to ILO convention" Ngige hala.

E advise labour leaders say make dem no misinform workers as wetin dey happun now na salary adjustment and no be review.

"E get some agency like NNPC, FIRS and Customs wey dia worker dey collect up to N300,000 and dis one pass wetin oda ministry worker dey collect even though dem get di same degree."

Di meeting between goment and di union go continue on Wednesday 16 2019.