Reports sey we rescue three Takoradi girls wey dem kidnap be fake news - Ghana Police

Ghana Police

Wia dis foto come from, AFP

Read am in 1 mins

Criminal Investigations Department (CID) for Ghana say news reports wey dey go around sey dem rescue de 3 kidnapped girls for Takoradi be fake.

Around Wednesday, one Accra-based newspaper report sey dem get tight filla sey police finally rescue de girls who dey go through some medical observation for some wey dey Accra.

While dis report raise expectations of de families, de Police Service sey dis report be fake as dem no fit confirm any rescue matter as de news outlet report.

Dem post for dema twitter handle top sey make people ignore de media reports.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Ghana Police early dis year arrest one Nigerian who confess sey he den en paddies kidnap de girls, so dem start dey trace where de girls dey.

Three weeks ago, CID boss, COP Maame Yaa Tiwaa Addo-Danquah organise press conference where she reveal sey dem finally know where de kidnapped girls dey, wey dem fit confirm sey dem be safe. Just sey dem dey work towards dema rescue.

But three weeks on, Ghanaians den families of de kidnapped girls no hear any news of dema rescue until dis fake news drop dis week.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

People start dey ask what exactly de police de look for which no make dem rescue de girls long time.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3