Buhari travel ban: Six oda 'Executive Order' Nigeria dey use fight corruption

Wia dis foto come from, NurPhoto
Presido Muhammadu Buhari 'Executive Order 6' over di weekend wey ban 50 Nigerians not to travel sake of corruption mata, na di biggest toking point on Monday for plenti kontri pipo.
Dis particular Executive Order 6 (EO6) na Oga Buhari order for federal goment to begin torchlight 50 top Nigerians wey goment don ban from travelling outside di kontri as dem dey torchlight dia case wey concern wayo and wuruwuru.
Na dis very order wey land on Friday night dey scatta pipo head, but wetin be Executive Order.

Wia dis foto come from, BAYOOMOBORIOWO
Executive order na di right wey president of any kontri get wey dem go fit give order to part of di executive arm of goment (but di presido fit pass boundary to wia di law allow am reach).
Na sometin wey just comot from years of judgement of wetin dem fit put under di office of di president of Nigeria.
But as much as di constitution get wia di power of executive order fit reach, dem no give any actual definition and dem dey leave di work give sabi pipo for education make dem find definition.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Executive Orders wey don shake Nigeria
- Executive Order One to ensure say business for Nigeria go dey move wella, alias Ease of doing business,dis order wey Vice Presido Osinbajo bin sign for May 2017 as acting Presido na say goment agencies go make am easy for pipo to do businesses. E make many happy sake di jara like sharp sharp company registration, plus order to reduce plenti paper work wey concern original document of goment paper so dat pipo fit sharparly arrange any documentation wey dem need for business.
- Executive Order Two bin dey about budget of federal goment agencies for di kontri for di next three years, for dat order no agency get right to pay any bill wey na continuous payment dem need except na di president tok am or e dey approved for budget.
- Executive Order Three na say make di federal MDAs dey buy more made in Nigerian products before dem look any oda product.
- Executive Order Four na for tax say pipo wey dey owe make dem come out by demself use dia church mind tok which property dem get for both inside and outside di kontri alias Voluntary Assets and Income Declaration Scheme - VAIDS and to pay di tax wey dey on top of am.
- Executive Order Five na di law wey say make no goment company give work or contract go outside di kontri except say e clear say pesin no dey Nigeria wey fit do di work and even at dat make dem use dat time train Nigerians to do di work.
- Executive Order Six na di one wey dey cause trouble. E bin come out for June dis year say any pesin wey get property wey dem suspect say na 419 dem use get am, dem no go allow di pipo wey get di asset fit touch am but e no mean say na goment come own am.
- Executive Order Eight na to prevent pipo to dey do money laundering. So, e give pipo till October 2019 make dem declare all di assets wey dem get abroad and all di money dem dey make from yonder.

Lawyers don chook mouth inside di latest Executive order 06 wey ban 50 Nigerians
Obinnah Amadi say dis kain order no dey legal as e dey crooss enta wetin judiciary d m dey do.
Amadi tell BBC Pidgin say separation of power wey di 1999 constitution tok say make all di tiers of goment stay for dia lane dey do wetin dem suppose do and make dem no cross enta wetin anoda arm suppose dey do.
Im say dis order show say na dictatorship wey Dey ground now, not democracy because of di case dem wey di pipo dey face still dey court, na court naim get right to give dat kain order.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Wen goment don assume absolute power and authority, den dat particular goment don become dictator kain of goment. Dis order na impediment on di court as e wan comot di jurisdiction wey di court get. Di 1999 constitution as amended naim be di organic law wey Dey guide evritin wey Dey di for dis kontri. For Buhari to make dis executive order 06, im dey collect di power of di judiciary. " Na so im tok.

But Kayode Fatai-Oso feel say di executive go don check wetin di law tok before dem come up wit dat kain order so if di pipo wey Dey affected feel say e no suppose be so, na for dem to carry am go court make court decide weda e dey correct or not.
"One tin dey clear, all of dem get one case to ansa wey Dey connected with corruption wey di federal goment dey fight. So for ban to dey places on dem, dem go follow due process to obtain dat ban so e go dey honourable if dem ho accept am and stay for di kontri and if dem dey innocent, dem no get anytin to worry about.
Even with separation of powers, weda you like am or not e get time wen di power fit overlap between di executive and judiciary. For dis situation and based on di sensitive mata wey Dey ground wey be say na corruption charge dem dey face, to one extent, yes di judiciary suppose get autonomy but e get certain mata of state wey go need di executive to dey involved. If dem get problem with di order, make dem go make application to di court." Na so Kayode tok.











