Jos crisis: Plateau State goment say na mistake bullet kill University of Jos student

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Dooshima Abu
- Role, BBC News Pidgin, Abuja
- Read am in 2 mins
Plateau State goment for north central Nigeria say na mistake bullet from military task force - Operation Safe Haven kill one 300 level law student for University of Jos.
Yakubu Datti wey be gi govnor tok-tok pesin, say as di military bin dey try control some jaguda pipo, some student come comot for di school area go chook hand for wetin dey happun.
Dis wan wey im tok different from wetin one student bin tell BBC on Monday, about wetin happun for di school. Di student bin say na pipo wey wear soldiers uniform enta di school begin shoot anyhow, come kill di student.
Kums Shadrack Fenan na di 300 level law student, wey bin die for di shooting, wey come make many students begin leave di school.
Miyetti Allah bin don tok say no be Fulani herdsmen attack di University
Mohammadu Nuru, di state chairman of Miyetti Allah, tell BBC Pidgin say Fulani pipo no dey live for di area wey di fight happun and dem no get hand at all for di gbege.
E tok say di fight na between criminal gang for di area and dat wen security pipo bin go dia to to chook eye for di mata, di bad gang attack dem.
Pipo bin post for social media last week say herdsmen attack one area and military come jam youths dem afta.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Some students bin tell BBC News say dem still dey hear gun shots but di police authority say dem don increase security for di school so students dey safe.
Tori be say one of di student wey wunjure and dem carry go hospital don go back to im house.














