Anglophone regions for October 1 go be laik graveyard, no waka about, no business

South Cameroon people gather
Wetin we call dis foto, Plenty men and women bin protest for 2017

Pipo for Anglophone regions no go waka from one village to de oda, afta order weh Northwest governor Adolphe Lele L'Afrique, and councils for Southwest region send for population.

Na from Sunday number 30 day for September go reach for number 1 day for October 2018 weh cars, motor-cycles no di move and motor-parks bi close.

Na dis first day for October secessionist di celebrate as dia 'independence' day and na day weh violence di ever bi for de regions. Last year secessionist and goment forces bin exchange fire for October 1.

Governor explain say e put dis order because secessionist forces don warn say deh go do bad activities for de region.

Before governor e order, secessionist say deh go stop election for de two regions and na two days now weh secessionist force cut head for commanda for Tatum- village for Northwest region, na de same tension dey for Southwest region.

Di governor say de order for stay for one place na for protect dem and dia property and make sure say deh bi safe.

For dis taim, na only ambulance, authorities, or some pipo weh deh get authorisation go move around.

No public place go bi open for up kontri, off-licence, night club, snack-bar more dan 4 pipo not go fit gada for one place.

Army and oda security forces go make sure say kontri pipo dem respect dis order.

No bi only for Northwest weh measures dey for keep pipo safe, na de same measure weh deh take for Buea council, Tiko council and odas, all place locked for two days, motor-parks, off-licence, night club, no business.

Just now deh don cut network for some parts for Northwest region laik Bui division weh call ni di pass since one week, and light no also dey, Bamenda woman don tell BBC News Pidgin.