West Ham vs Arsenal results: Highlights as Gunners beat Hammers 2-1 to secure fourth position on Premier League Table

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal beat West Ham 2-1 for London Stadium to secure dia top four position ontop di Premier League Table.
Dem bin dey look to to secure dia top-four place and Champions League qualification as dem visit West Ham for di London Stadium. Di Gunners bin move back to di pole position for fourth spot afta dem win Chelsea and Manchester United.
West Ham bin dey also aim to qualify for di Champions League.
See how di match happun LIVE
KICK-OFF
1 Min: 1West Ham 0-0 Arsenal
Game don start!
Arsenal win a corner within 30 seconds but dem head Bukayo Saka delivery away.
5 mins: Aside from di early Arsenal corner e dey somehow quiet.
End of Di one wey oda users dey read well well
10 mins: Di hosts try to work di ball down di left but space no dey but dem turn am backwards.
Granit Xhaka pass di ball out of defence into di West Ham half but den di ball towards di edge of di box dey stopped.
West Ham dey play well as dem try to make sometin happun.
Vladimir Coufal and Pablo Fornals combine well before di cross dey deflected behind for West Ham first corner of di game.
Jarrod Bowen send ball enta di box but Aaron Ramsdale punch am away.
15 mins: West Ham dey see more of di ball at di moment as dem continue to try and find way down di wings.
Aaron Cresswell pump di ball to di edge of di Arsenal area, trying to find di run of Aaron Ramsdale but di Arsenal goalkeeper dey quick off di line to gada first.
Almost one quarter of an hour gone and no chance. We never get one shot on or off target yet from either side.
Mohamed Elneny dey caught by a late challenge by Kurt Zouma and e dey down on di ground wit injury. Di Arsenal midfielder eventually dey OK to get up and continue before Granit Xhaka get di game first shot in anger, but im effort dey blocked.
20 mins: Eddie Nketiah turns and shoots from 25 yards. Ambitious, but he does win a corner as the shot is blocked. Martin Odegaard sends in the corner but Kurt Zouma powers a header away.
Eddie Nketiah turn and shoot from 25 yards. Ambitious, but e win one corner as di shot dey blocked. Martin Odegaard send in di corner but Kurt Zouma send a header away.
Another corner for Arsenal, dis time Lukasz Fabianski punch am out before di whistle go off for a foul inside di box.
25 mins: Said Benrahma try to go past Takehiro Tomiyasu on di left before e cross low into di box but e no fit keep di ball in play.
Nuno Tavares put in a cross from di left but e dey cleared out by di West Ham defence.

Wia dis foto come from, Getty Images
30 mins: Kurt Zouma dey high up di pitch and e feed Said Benrahma on di left. Di forward twist and turn before crossing for Zouma, nut e header hit a defender.
Quick check for a possible handball but na only a quick check and dem no give am.
We dey go close to a shot on target as Pablo Fornals lash in one effort over afta one cross cause small panic for di Arsenal defence.
Arsenal get anoda corner but Gabriel Martinelli's delivery na sometin wey Lukasz Fabianski catch.

Wia dis foto come from, Getty Images
35 mins: West Ham break quickly and di ball dey worked across di area to Manuel Lanzini, wey im shot dey blocked by Rob Holding.
Declan Rice drive through di middle and hit a decent low effort at goal but e go straight to Aaron Ramsdale.
Dat na di game first shot on target.
40 mins: Vladimir Coufal bend di ball down di flank. Jarrod Bowen dey dia to take am pas Arsenal defence but unfortunately Coufal send am out of play.

Wia dis foto come from, Getty Images
GOAL - West Ham 0-1 Arsenal
Rob Holding, wey start for di injured Ben White, heads Arsenal into di lead from one corner afta a good run and shot by Eddie Nketiah for di 39th minute.
Dat na im first goal since 2019 and e put Arsenal back into di top four as tins stand.
45 mins: West Ham almost respond immediately as Declan Rice header from a corner dey pushed over by Aaron Ramsdale.
West Ham win anoda corner but dis one dey headed away.
GOAL!
West Ham 1-1 Arsenal
Arsenal no fit hold on!
Declan Rice spot di run on Vladimir Coufal, wey cross from di right to find Jarrod Bowen and im shot take a slight deflection on im way into di net for di 44th minute.
Di Hammers don level!

Wia dis foto come from, Getty Images
HALF TIME
West Ham 1-1 Arsenal
West Ham win a late corner but Mike Dean decide to blow for half time.
SECOND HALF
KICK-OFF
West Ham 1-1 Arsenal
Game don start.
50 mins: West Ham pick up from wia dem leave off as a low ball into di box run through to Said Benrahma, wey im effort strike Rob Holding head.
Bukayo Saka clip di back of Jarrod Bowen ankle right in front of Mike Dean and di referee no hesitate to show a yellow card to di Arsenal man.
55 mins: West Ham continue to look di most dangerous as Said Benrahma put in a cross from di left but Granit Xhaka head am out.
Aaron Ramsdale flying out of im area as Jarrod Bowen nin dey look to break clear.
Bowen go down as Ramsdale slide in, contact no dey and na West Ham forward collect yellow card for di 54th minute.

Wia dis foto come from, Getty Images
GOAL!
Gabriel score.
Arsenal dey back in front!
Bukayo Saka win Arsenal corner as im strong shot dey pushed behind.
Di corner dey headed away but Gabriel Martinelli pick am up to find Gabriel, who head am in.
60 mins: West Ham go need to respond again and Arsenal will go need to dig deep because di hosts dey put dem under all sorts of pressure.
Eddie Nketiah dey di box and dey sight goal but im fire straight give Lukasz Fabianski.
Thirty minutes for West Ham to find anoda equaliser. If dem fail to win dis one e go be just one win in dia last six games inside Premier League.
Eddie Nketiah dey picked out by a ball from di back and e dey able to break down di left. E no get immediate support so e decide to go for goal but Lukasz Fabianski saves am.
65 mins; West Ham still dey hustle for goal but Arsenal dey try to retain control.
E be like say Jarrod Bowen still no happy about di booking e get earlier. E de call on Mike Dean but e be like no response.
70 mins SUBSTITUTION
West Ham make change as dem dey look to equalise and Michail Antonio come on for Manuel Lanzini.
Pablo Fornals meet one cross with volley but e dey blocked and den Arsenal break quickly as Mohamed Elneny send Eddie Nketiah. Di forward run towards di West Ham area before e send di ball just wide of di far post.
75 mins: Vladimir Coufal send in one cross with Michail Antonio ad di target but e dey too close to Aaron Ramsdale.
SUBSTITUTION
West Ham 1-2 Arsenal
Takehiro Tomiyasu dey receive some treatment so West Ham decide to make change during di pause in play as Tomas Soucek come on for Mark Noble for di 78th minute.
80 mins: Eddie Nketiah capitalise on one wayward pass by Vladimir Coufal and once again charge towards goal. E fire one low shot from outside di box wey Lukasz Fabianski get to push behind. Di corner no do anything.
Another change for West Ham as Said Benrahma dey replaced by Andriy Yarmolenko.
Arsenal also send on Cedric for Takehiro Tomiyasu a few minutes earlier.
Even if top four fit done go for West Ham dem no go wan drop out of di top seven. Dem be currently seventh but Wolves dey four points behind and get one game in hand.
85 mins: West Ham fans dey vex because dem tink sey dem suppose get corner as Michail Antonio cross deflect behind but na di right call as e rebound back on to Antonio before e go behind.
Bukayo Saka done go down a couple of times so e dey clearly struggle. E dey replaced by Emile Smith Rowe for di final few minutes.
90 mins: Eddie Nketiah collect yellow card as e stop West Ham to play free kick. Dis wan be wan start gbege but dem stop am.
Declan Rice still no happy with Nketiah.
90+1 min: SUBSTITUTION
Albert Sambi Lokonga dey on for di final few minutes for Arsenal as dem look to see di game out. E replace Martin Odegaard.
We dey into four minutes of added time.
90+3 mins: Arsenal break through Emile Smith Rowe. Di midfielder reach di edge of di area, e pass to Eddie Nketiah, wey come play in Albert Sambi Lokonga but di substitute play am high and wide.
FULL-TIME
West Ham 1-2 Arsenal
E don finish! Arsenal stand gidigba to take three points wey move dem back into di top four.
West Ham eye dey on Europe but dem need to be careful not to drop out of di top seven.












