Man United vs Leicester City highlight: Kelechi Iheanacho score for Leicester City as dem draw 1-1 wit Manchester United

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester United fail to close di gap on Champions League spot as dem only fit draw 1-1 wit Leicester City.
Di Red Devils wey bin dey without Cristiano Ronaldo bin fall behind through Kelechi Iheanacho header on 63 minutes.
United draw demsef level through Fred as di Brazilian pounce on loose ball afta Schmeichel don save Fernandes shot into im path.
Di Old Trafford club for even fall further behind if no be VAR wey cancel Leicester City goal.
James Maddison blast Iheanacho shot past David de Gea but di Nigerian according to VAR bin don foul Raphael Varane for di build up to di goal.
One point from dis game no go do United any favours as dem don play two matches more dan Arsenal wey dey fourth place.
Wit eight matches to play United dey sixth for table wit 51 points while Leicester City dey 10th wit 37 points.
Di Foxes still get three more outstanding matches to play.
End of Di one wey oda users dey read well well
How di match go
Second half
46 mins - Change for Manchester United. Shaw wey bin get injury don comot and Telles don enter.
United restart di match and straight from dia Leicester City win corner.
Di Red Devils clear di cross from Maddison.
49 mins - Scott McTominay collect Yellow card.
55 mins - Rashford don come on in place of Scot McTominay wey bin don see yellow card.
63 mins - Goal! Kelechi Iheanacho give Foxes lead for Old Trafford
Di goal wey see Iheanacho connect wit Maddison cross wit im head na Leicester first shot on target for dis match.
64 mins - Substitution: Daniel Amartey ON for Johny Evans.
66 mins Goal! United equalise through Fred.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Brazilian convert rebound afta Schmeichel don save Fernandes shot.
Manchester United 1-1 Leicester City.
71 mins - Iheanacho wit anoda chance to give di Foxes di lead again...di Nigerian loop im shot ova di onrushing De Gea.
72 mins - A minute later, di Spanish goalkeeper produce anoda good save to deny Fofana. Wow!
75 mins - Nemanja Matic don replace Paul Pogba for United.
80 mins - Goal for Leicester City? Maddison don give di visitors di lead again.
Di midfielder fire di shot into di net from Iheanacho pass. But di referee dey go check am for VAR.
Afta one or two glances, Andre Marriner say no goal as Iheanacho bin foul Raphael Varane. Still Manchester United 1-1 Leicester City.
84 mins - Tielemans try im luck from outside di box but di shot no get power, De Gea catch am.
90 mins - Leicester City substitutions. Daka and Choudhury ON, Mendy and Iheanacho OFF.
90+2 mins - Sancho shoot wide afta Amartey bin slip.
First Half
1 min - Leicester City take di first kick of di game as di match don start.
Andre Marriner na im be di referee for today.
2 mins - Leicester win freekick near United eighteen. Barnes head over Maddison cross from di freekick.
5 mins - Luke Shaw collect di game first yellow card as im bring down James Justin. Di ref consider di foul to be serious challenge.
10 mins - Fred try to play Elanga clean through but Evans block im through pass.
11 mins - Leicester play dioa way through United defence wit neat passing, Barnes finally shoot but im shot go wide.
16 mins - Yellow card for Fofana wey bring down Elanga. Fernandes try to find Maguire but di big man no fit connect wit di shot.
20 mins - Almost a quarter of di match don pass and both sides neva create much.
26 mins - Save! Schmeichel use im legs to stop Bruno Fernandes ground shot afta di Portuguese don dey through on goal. First big chance of di match.
30 mins - Yellow card for Tielemans.
35 mins - Leicester City almost take di lead through Harvey Barnes. Di midfielder glanced shot from Maddison cross go over.
40 mins - United wan make early substitution, Luke Shaw look like say im dey injured. Alex Telles dey ready to replace am.
42 mins - Afta some treatment, Shaw go continue.
45 mins - Linesman flag Fernandes don enter offside. Di ref don add three minutes extra for dis first half.
Possession - Manchester United 56% - 44% Leicester City
Manchester United vs Leicester City Lineup
United XI: De Gea, Dalot, Varane, Maguire, Shaw, McTominay, Fred, Fernandes, Pogba, Sancho, Elanga. Subs | Henderson, Telles, Jones, Lindelof, Wan-Bissaka, Mata, Matic, Lingard, Rashford.
Leicester City XI: Schmeichel, Justin, Evans, Fofana, Castagne, Tielemans, Mendy, Maddison, Dewsbury-Hall, Barnes, Iheanacho. Subs | Söyüncü, Albrighton, Pérez, Amartey, Choudhury, Ricardo Pereira, Daka, Jakupovic, Lookman.












