Cameroon vs Comoros Afcon 2021 Quarterfinal: Cameroon don knock 10-man Comoros out of Afcon 2021

Comoros midfielder, El Fardou Nabouhane and Vincent Aboubakar of Cameroon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Comoros midfielder, El Fardou Nabouhane and Vincent Aboubakar of Cameroon

Cameroon narrowly beat 10-man Comoros for di last 16 for di Africa Cup of Nations, despite say dem playing against side wey get outfield player for goal.

For di history of Afcon dis na di first time Cameroon and Comoros go meet.

Goals from Karl Toko Ekambi and Vincent Aboubakar na im give di Indomitable Lions a 2-1 win after Nadjim Abdou don chop red card early.

But Comoros go take di headlines after giving di hosts massive scare.

Youssouf M'Changama na im score stunning free-kick and Chaker Alhadhur, normally a left-back, produce brilliant performance as stand-in goalkeeper.

Cameroon don progress to go face The Gambia for quarter-finals on Saturday.

Cameroon get early advantage as Comoros 3 keepers no dey available

Debutants Comoros, ranked 132nd for di world, enta di game without a recognised keeper after Salim Ben Boina dey ruled out through injury and Ali Ahamada and Moyadh Ousseini don test positive for Covid-19.

Di Indian Ocean islanders bin dey hope say Ahamada fit return after negative test for di morning of di game, but organisers Confederation of African Football (Caf) tok say di 30-year-old neva fulfilled im protocols.

Facing di biggest game for diafootball history, di Coelacanthes' hopes of causing a huge upset dey dealt wit seemingly disastrous blow wen captain Abdou dey sent off for di 7th minute after catching Moumi Ngamaleu on di ankle wit im studs.

E be tackle wey seem clumsy rather dan malicious but di potential danger to Ngameleu dey there and after a video assistant referee review, Ethiopian referee Bamlak Tessema Weyesa sent off former Millwall man Abdou.

Also without coach Amir Abdou sake of coronavirus, Comoros dey already at substantial disadvantage wit Alhadhur for goal and after di dismissal a raucous Olembe Stadium for Yaounde fully expect di Indomitable Lions to go on and score a hatful.