Chelsea vs Man City: Gabriel Jesus goal end Chelsea unbeaten start to Premier League season

Wia dis foto come from, Getty Images
Gabriel Jesus second half goal help Manchester City defeat Chelsea 1-0 for dia own backyard.
With two strikers on di pitch, Chelsea struggle to create chances as City end dia unbeaten start to di 2021/2022 Premier League season.
Jesus deflected shot for di 53rd minute break di Chelsea defence wey don look solid dis season.
Jesus almost score second goal wen Thiago Silva clear im effort off di line while Aymeric Laporte for score but im somehow slide e shot wide from inside di six-yard box.
Mendy also produce two crucial saves from di excellent Jack Grealish.
Before di game, Pep Guardiola bin don lose di last three matches wey im don play against Thomas Tuchel Chelsea including last season Champions League final.
Now, Guardiola and im boys don get di better of Chelsea as dem dominate di Blues for Stamford Bridge.
More dey come.
End of Di one wey oda users dey read well well










