CHAN 2020: Cameroon win Zimbabwe as African Nations Championship kick off with style

Di Indomitable Lion

Wia dis foto come from, CAF

Read am in 3 mins

Cameroon succeed for opening ceremony of 6th edition of CHAN 2020, wit wonderful opening ceremony, beat Zimbabwe 1-0.

De cultural spectacle showcase culture from Sahel, Grassfield, Fang-Beti and Sawa cultural zones.

Kontri pipo watch blend for dance style, music and costumes.

Local organizing committee make sure say all man respect COVID-19 rules, all man wear masks and volunteers share hand sanitizers.

Even sitting position bi respected, as na only about 12,000 supporters enta 40,000 seater Amadou Ahidjo Stadium.

Fans for staduim

Some lions supporters vex say authorities no give dem tickets for enta field but say deh go continue for cheer lions.

For field, Lions quench supporters dia taste for goals. Lions show say deh di hungry for score but waste most of dia chances. Den opportunity kam for 73rd minute, Salomon Banga put smile for supporters dia face wit goal.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Cameroon win dia first match, give hope for supporters weh de doubt dem from pre-CHAN tourney.

De indomitable lions of Cameroon and Warriors of Zimbabwe na two teams weh problems no let dem prepare well for de African Nations Cup, CHAN.

Zimbabwe team

Wia dis foto come from, CAF

Cameroon nova play league games since Covid-19, also tug of war between Cameroon football federation and football league no let de championship start.

From dia prep games, deh draw level for one, den loss two, and de team no di convince Cameroonians say deh fit go far, beta dan dia quarter final 2016 outing.

Jack Zoua, 2017 Afcon champion player weh e no get club now, na de striker to look out for wit e experience. Home crowd and turf go fit bi big booster for Cameroon team.

Laik Cameroon, de Warriors of Zimbabwe no play league games as dey prepare for dis tourney. Dia coach, say deh get 20 hours preparation.

Covid-19 worry dem, 9 players and five staff bi catch de sick , and e take dem take some taim for recover before December 2020.

Football fans for di staduim

Zimbabwe na one kontri weh ever glad if Caf bi shift de tournament.

Zimbabwe, and coach Zdravko Logarusic no get de same preparation laik Cameroon wit mini tournament, even if deh get only one point and one goal.

Cameroon di play for dia home turf and wit dia supporters though de number small.

Fans for staduim

Female central referee

Surprise for dis match na one of de four women out of 47 and referees and assistants for officiate opening match as central referee, Ethiopian, Lydia Tafesse.

Odas na Bernadette Kwimbira of Malawi, Mimisen Lyorthe of Nigeria and Carine Athezambong Fomo from Cameroon.

Pictures from opening ceremony

Opening ceremony display

Wia dis foto come from, CAF

Opening ceremony display

Wia dis foto come from, CAF

Football fan

Wia dis foto come from, CHAN