Egypt vs South Africa: Coach Aguirre chop sack, FA President Abou-Rida resign afta Bafana Bafana knockout Pharaohs from Afcon 2019

Egypt

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Javier Aguirre chop sack afta South Africa beat Egypt 1-0 for Cairo

Host, Egypt don sack dia national team coach Javier Aguirre afta South Africa knock dem out for di round of 16 of di 2019 Africa Cup of Nations.

South Africa shock Egypt on Saturday night as dem beat dem 1-0 for Cairo Stadium, as di Pharaohs fail to reach di quarter-finals for di first time since 2004.

Afta di match, Egypt Football Association (EFA) president Hany Abou-Rida announce say im dey resign and confam say di whole technical and administrative staff go waka too.

Egypt appoint Mexican coach Aguirre afta dem comot from di group stage for di 2018 World Cup in Russia.

Former Japan and Mexico coach Aguirre wey replace Hector Cuper bin sign four year contract last year.

Aguirre tok afta im team lose say; "Of course na me you go blame.

"I feel say di game bin dey open and di two teams create chances. Di only difference na di goal wey South Africa score."