2019 AFCON: Caf President say Cameroon go bi host

Biya, Ahmad and Eto

Wia dis foto come from, President Biya/Twitter

Read am in 2 mins

Confederation of Africa Football Caf President, Ahmad Ahmad say e nova ever check for take away 2019 Africa Cup of Nations, AFCON host from Cameroon.

Cameroon na host for 2019 AFCON and plenti tok say deh fit take de host from di konrti bi di circulate.

Caf boss Ahmad Ahmad enta kontri for sharp morning meet with President Biya and den attend big reception weh deh give e for Yaoundé.

Afta Caf president tell media pipo say e nova ever check for take away AFCON host from Roger Milla Kontri.

"Caf no get any plan B. Caf no bi don ever check say deh go take away AFCON from Cameroon", Ahmad tok.

"E lef for Cameroon for tell we, no be we di organise; na Cameroon go tell we say deh bi ready or abeg give we taim", Caf boss add.

Caf President

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO

Wetin we call dis foto, Samuel Eto'o and caf President for Liberia

Ahmad thank Samuel Eto'o Fils weh e organise dis meeting for move all doubt and tok say deh go take rights from Cameroon.

Ahmed tok say President Biya don give assurance say Cameroon go bi ready for host di African football jamboree.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis visit di kam afta two days weh caf say deh go give dia final answer if Cameroon go remain host or not for November.

Caf boss bin say deh no go make dia decision before presidential election for seka say deh no wan spoil campaign.

Caf di worry for de kana delay for construction for field and hotels dem and also for security how weh fight dey for Anglophone regions.

Inside de delegation weh e kam with Caf boss na vice- Président Constant Umari, and Cameroon striker, former captain, Samuel Eto'o Fils.

For airport, Sports Minister, Pierre Ismael Bidoung Kpwatt welcome de August guest with some former lions dem Joseph Bell Antoine, Rigobert Song and odas.

Cameroon go be de first kontri for host AFCON with 24 teams and de competition go start for June end for July.