Chameleon work, security problem fit make Cameroon no host AFCON

Wia dis foto come from, Gabriel Nlonga
CAF don say na for November deh go decide if Cameroon go still host 2019 Africa Nations Cup, AFCON.
Dis football bodi for Africa say de last mission for inspection for Cameroon show how far work di go on for Cameroon.
"Video report show say Cameroon di delay for finish construct de infrastructure weh deh go use for 2019 AFCON", CAF tok.
Also deh say na for November weh final decision go komot afta de check construction with some audit company, Roland Berger.
Before dat, CAF president Ahmed Ahmed say deh no go make decision before election and deh no spoil election campaign.
But before deh decide CAF and FIFA officials go kam Cameroon dis moon for October for check security situation for kontri.
Now so fight dey for Southwest region as e concern de Anglophone crisis and na one of de site dem weh deh go play Ndamba for 2019 AFCON.
Na from number 15 day for June go reach Number 13 day for July weh AFCON go take place dis year with 24 teams.
End of Di one wey oda users dey read well well
CAF decide say Ghana na still host for 2018 Women AFCON afta dark cloud be hang for dia host for seka problems for dia football federation.











