Fulham vs Liverpool highlights: Mo Salah score equaliser for di Reds afta Aleksandar Mitrovic penalty

Salah dey score

Wia dis foto come from, Getty Images

Fulham hold Liverpool to a 2-2 draw wen dem jam for Craven Cottage.

Di 90 plus minutes game wey dey action packed see di Cottagers take di lead two times before di Reds equaliser.

Fulham bin dey without Harry Wilson and Nathaniel Chalobah wey pick up injuries during di pre-season tour.

Liverpool also bin dey without Ibrahima Konate, Curtis Jones, Kostas Tsimikas, Diogo Jota, Caoimhin Kelleher and Alex Oxlade-Chamberlain wey dey recover from injuries dem sustain over di summer.

Dem also bin dey without Nabiy Keita.

Live updates as di match happun

FIRST HALF

Game don start!

1 min: Aleksandar Mitrovic spot early opening to run inside Liverpool box and e play di ball wide.

4 mins: Fulham dey hold Thiago Alcantara for work, e no dey fit pass well. Di Reds win free-kick wen two cottagers bump into am.

6 mins: Corner kick for Fulham but Joel Matip head am out. As di Cottagers bring am back in, Virgil van Dijk clear am out.

8 mins: Fulham Harrison Reed cross from di left side of Liverpool box enta goalkeeper Alisson hand straight.

15 mins: OFFSIDE GOAL!

Luiz Diaz score but na offside.

Andy Robertson dey off before di ball reach Luis Diaz.

16 mins: YELLOW CARD!

Kenny Tete collect yellow card for encounter with Luis Diaz

21 mins: Andy Robertson get opportunity inside final third and e put a cross enta di far post but Fulham left-back Antonee Robinson head am out.

24 mins: Fulham fire shot from outside di box but e dey deflected go corner, but Liverpool clear am out.

28 mins: Fabinho cross from deep on di right dey blocked for a Liverpool corner.

30 mins: Andreas Pereira cross dey cleared behind for corner, e no amount to anytin, but Harrison Reed strike hit di edge of di box as e dey blocked by Andy Robertson from Antonee Robinson cut-back.

33 mins: GOAL!

Fulham 1-0 Liverpool

Aleksandar Mitrovic score to give Fulham di lead.

Aleksandar Mitrovic (centre) scores for Fulham

Wia dis foto come from, Getty Images

35 mins: Liverpool complain afta Fulham player stand ontop Jordan Henderson leg afta Liverpool midfielder give di ball away.

Mitrovic also lean on Alexander-Arnold as e jump above am. Di officials feel say e no reach for a free-kick.

35 mins: Andy Robertson put in low cross to di goal but Luis Diaz no fit reach am.

39 mins: Close again! Luis Diaz get room to fire shot away from di left side of di Fulham box but e shoot off far from post.

45 mins: Marek Rodak gada Luis Diaz header across di goal very easily.

45 mins+2: HALF TIME!

Fulham 1-0 Liverpool

Second Half

Match don start!

Fulham 1-0 Liverpool

Nobody make any change.

49 mins: Thiago Alcantara don injure e dey match one leg for ground

50 mins: Liverpool Substitution

Thiago comot for Harvey Elliott.

New signing Darwin Nunez come on for Roberto Firmino.

52 mins: Tim Ream concede corner afta e come under pressure from Trent Alexander-Arnold. But afta di push for di ball for di goal mouth side, di flag go up for offisde.

56 mins: Fulham Andreas Pereira try to find Harrison Reed but e no work, e try to shoot e dey blocked.

57 mins: Fulham Neeskens Kebano collect ball on di and e shoot strike but e no enta.

59 mins: Liverpool Substitution

Di Reds make dia third change as midfielder Fabinho go off for James Milner.

60 mins: Tosin Adarabioyo give di ball away just outside di Fulham box and Liverpool Darwin Nunez find di ball but e try to square am instead of going for goal.

63 mins: Goal!

Nunez score for Liverpool. E get am right dis time. Na Mo Salah pass di ball give am.

Darwin Nunez (centre) scores for Liverpool

Wia dis foto come from, Getty Images

70 mins: Penalty for Fulham!

Van Dyke catch Mitrovic leg afta e run meet am and e go down. referee blow whistle. Opportunity for Fulham to take back di lead.

72 mins; Goal!

Mitrovic take di penalty and e score.

Mitrovic take di penalty

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mitrovic take di penalty

77 mins: Substitution for Liverpool!

Na di last one for dem. Fabio Carvalho replace Luis Diaz

80 mins; Goal!

Liverpool equalise. Na Mo Salah score.

89 mins: Substitution

Andreas Pereira comot for Tom Cairney.

90 + 3mins: Close!

Shot from Jordan Henderson hit di bar.

90+ 5 mins: Final Whistle

Full Time

Fulham 2-2 Liverpool

Liverpool line-up

Liverpool XI: Alisson, Alexander-Arnold, Matip, van Dijk, Robertson, Henderson, Fabinho, Thiago, Salah, Firmino, Diaz.

Substitutes: Gomez, Milner, Adrian, Elliott, Nunez, Carvalho, van den Berg, Bajcetic, Chambers.

Liverpool line-up

Wia dis foto come from, Other

Fulham line-up

Fulham XI: Rodak, Tete, Adarabioyo, Ream, Robinson, Reed, Palhinha, Reid, Pereira, Kebano, Mitrovic.

Substitutes: Solomon, Leno, Duffy, Mbabu, Cairney, Muniz, Francois, Harris, Stansfield.

Fulham line-up

Wia dis foto come from, Other