FPSO explosion: Three Crew members from oil vessel wey explode for Delta state dey alive

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem don find alive three crew members from di oil vessel wey explode for Delta State on Wednesday, 3rd February 2022.
Di management of Shebah Exploration & Production Company Ltd (SEPCOL) for statement say one pesin die for di fire wey burn FPSO Trinity Spirit for Ukpokiti Terminal but dem neva fit identify di deadi body.
Na 10 pesins bin dey di ship wey catch fire around di southern Nigeria oil-rich Delta State.
Di company Chief Executive Officer for statement, Ikemefuna Okafor say: "We fit confam say we don find three crew members alive for di community and our priority na to ensure say dem receive appropriate medical attention dem need".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Okafor also tok say di company, stakeholders and relevant authorities visit di place on Saturday, 5th February to do inspection.
"Di focus of our joint efforts na to prioritise investigations to know di whereabouts, safety, and security of di seven crew members wey still dey miss, clean up and limit damage to di environment, and establish di cause of di explosion.
'Vessel wey explode fit store two million barrels of oil'
Na Shebah Exploration & Production Company Ltd (Sepcol) na im get di vessel wey explode.
Di vessel na FPSO Trinity Spirit and e dey for Ukpokiti Terminal, around Excravos, Warri South-West Local Government Area of di state.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say di ship get 10 crew members wen e explode on Wednesday.
Di vessel wey explode get capacity to store up to two million barrels of oil.

Wia dis foto come from, Harrison Okene/Facebook
Okafor wey be official of di company at di time wey di incident happun bin say "Sepcol dey prioritize investigations wit respect to dia safety and security."
E also say dem alert all relevant authorities about di development.
Ikemefuna Okafor add say "We appreciate di assistance wey Clean Nigeria Associates, Chevron team wey dey near Escravos facility, and our community stakeholders as well as fishermen provide us."
Delta state goment no respond to our call to know wetin dem pla to do on top di explosion.











