How one man shoot Brazilian Jiu-Jitsu champion for head inside club

Wia dis foto come from, Getty Images
Health officials don declare one of Brazil greatest Jiu-Jitsu champions of all time brain dead, afta one man shoot am for head for one Sao Paulo Club.
Leandro Lo na one of di most successful Jiu-Jitsu athletes of all time, as e don win World Championships eight times.
Eye witnesses wey tok wetin happun say, one man bin approach Lo and im friends begin threaten dem, Lo just touch di man small, afta e free am to go, di man shoot am.
Di suspect run comot di scene but e don go report and hand imself ova to police.
Dem don open investigation for attempted murder.
One friend of Lo wey dey wit am dat time say, one man just approach dia table, carry bottle and begin wave am like say e wan chook dem.
Lo come pin di man to di ground “to calm am down” but afta e let am go. Di man shoot Lo for head, di unnamed friend tell Brazilian news site G1.
One lawyer for Lo family, Ivan Siqueira Junior, say Lo and im friends bin try prevent di incident make e no spread.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to Oga Siqueira, di suspect kick Lo two times for ground afta e don shoot am for head.
Dem rush Lo go hospital, wia dem declare am brain dead. Im family say im condition dey irreversible.
Di 33-year-old don win World Championships eight times for five different weight classes, an all time record.
Di International Brazilian Jiu-Jitsu Federation called am "one of di greatest athletes our sport don ever produce".
"An example of a true black belt, martial artist and champion on and off di mats," di federation tweet.












