Ivory Coast come from behind to defeat Nigeria 2-1 and win 2023 Afcon

Gradel lift di trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ivory Coast don win three Afcon titles: for 1992, 2015 and 2023

Sebastian Haller 82nd minute goal ensure Ivory Coast come from behind to defeat Nigeria 2-1 to win di 2023 Africa Cup of Nations.

Nigeria bin take di lead through William Troost-Ekong header from a cornerkick on 38 minutes wit di Super Eagles only shot on target.

Looking shocked from conceding di hosts press on to find di equaliser but find am difficult to go past Nwabali wey dey in goal for Nigeria.

Di equaliser finally come two minutes afta di hour mark as Franck Kessie connect wit Adingra cross from a cornerkick to head di ball past Nwabali.

Wit di game deadlocked, Sebastian Haller step up to score wetin prove to be di winner wen e stretch im leg to tap in Adingra cross into di net to make am 2-1.

Dis na di third time wey Ivory Coast go win di Afcon afta dem win am for 1992 and 2015.

From early elimination to becoming champions

Very few people go fit predict say dis Ivory Coast team wey qualify as one of di four best third-place team go reach di final not to tok of winning di cup.

Di Elephants lose two of dia group games much to di disappointment of dia fans and FA wey later sack di coach, Jean Louis Gasset.

Interim coach, Emerse Fae step in and reorganise di team as dem go all di way defeating di defending champions Senegal on penalties for di last 16.

Dem also knockout Mali for quater-final and DR Congo for di semis before dia spirited display see dem overcome Nigeria afta dem fall behind.

Na di first time wey any team go lose two group match for tournament but go on to win di Afcon.

Recap how di match go

Second half

Sebastian Haller celebrate

Wia dis foto come from, Getty Images

FT: Nigeria 1-2 Ivory Coast

Di referee don blow im final whistle as Ivory Coast win di 2023 Africa Cup of Nations.

90+7 mins - Yellow card for Evan Ndicka for time wasting. Di hosts don almost reach di finish line.

90+1 mins - Seven more minutes na im referee don add before full time.

Ivory Coast replace Seri wit Amani.

90 mins - Iheanacho try to shoot shot inside di Ivorian box, Ndicka use im body to block am.

Adingra try to counterattack but Aina bring am down. Im collect yellow card.

88 mins - Fofana receive yellow card for time wasting. Di midfielder take im time to leave di pitch afta dem substitute am. Sangare and Krasso don come on for Fofana and Haller.

86 mins - Nigeria send on Moffi and Aribo to find di equaliser. Sanusi and Onyeka na dem come off.

84 mins - Nigeria now get cornerkick to create sometin, Iheanacho send im cross beyond everybody as di ball go out for goalkick.

81 mins - Goal for Ivory Coast! Haller direct Adingra cross into di net.

Nigeria 1-2 Ivory Coast

79 mins - Sanusi send di freekick straight to the goalkeeper.

78 mins - Nigeria make two changes. Iwobi and Lookman don leave di pitch, Iheanacho and Yusuf don take dia place.

Just before dat substitution Fofana bin foul Osimhen wen two of dem contest aerial ball.

77 mins - Play don resume afta di cooling break. Nigeria 1-1 Ivory Coast.

74 mins - Sebastian Haller bicycle kick Adingra header wide of di post.

Time fo cooling break.

70 mins - Substitution for Ivory Coast: Gradel and Aurier OFF, Singo and Diakite ON.

68 mins - Aurier bring down Lookman wey bin don dribble am. From di freekick Ekong head am just high over di bar.

Kessie equalise

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na Kessie second goal for Afcon 2023

63 mins - Goal for Ivory Coast. Kessie head Gradel cornerkick past Nwabali into di net.

Nigeria 1-1 Ivory Coast

62 mins - Nwabali wit anoda save to keep out Kossounou long range shot.

60 mins - Nigeria defence fail to deal wit up ball wey fall to Adingra, di winger send am in Kessie head am but e no get power Nwabali catch am.

58 mins - Seri try to create sometin wit a shot from outside di box e no dey on target.

56 mins - Substitution for Nigeria. Moses Simon don come on for Chukwueze.

53 mins - Nwabali and Aurier now don collect yellow card for arguing strongly about di incident. Play don resume afta Gradel receive treatment.

52 mins - Gradel now don go down inside di box afta im attempt to dribble past Sanusi. Di winger dey tell di ref say di defender bring am down but di ref no dey interested.

50 mins - Osimhen clear di freekick but Ivory Coast send di ball back into di box, Nwabali push am out to Gradel wey waya di ball but Bassey block am from going in. So close for Ivory Coast.

48 mins - Sanusi bring down Gradel just outside di area, freekick to Ivory Coast in a dangerous position.

46 mins - Ivory Coast wey dey lose 1-0 don resume play to signal di start of di second half.

First half

Nigeria celebrate

Wia dis foto come from, Getty Images

HT: Nigeria 1-0 Ivory Coast

45+4 mins - Fofana test Nwabali wit a long range shot, too easy for di goalkeeper. Dat na di final action for dis half as di ref don blow im whistle for half time.

45+3 mins - Kessie dey lucky to escape a yellow card wen him use im hand to block Sanusi from charging forward.

45+2 mins - Dat header by Ekong na Nigeria first shot on target for dis match, Ivory Coast don get two.

45 mins - Ref Beida add four more minute before half time. Meanwhile Osimhen dey okay to kontinu di match.

44 mins - Osimhen chase down one loose ball, im keep am in play but e be like di striker need treatment.

38 mins - Goal for Nigeria! Troost-Ekong head di cornerkick in to di net to give Nigeria di lead.

Nigeria 1-0 Ivory Coast

37 mins - Now Nigeria catch out Ivory Coast wit quick through to Iwobi wey find Sanusi, im shot dey blocked e go out from cornerkick.

33 mins - Good save by Nwabali to deny Adingra from scoring! Di winger receive good through pass from Kessie before im shoot e shot at Nwabali wey parry am out well. Sanusi tap am out for cornerkick.

From di corner Nigeria head di ball out of dia box.

30 mins - Referee Dahane Beida don signal for cooling break. Time to calm tins down as di match bin don dey heat up following a challenge by Adingra on Nwabali.

28 mins - Now Nigeria coach Jose Peseiro don collect yellow card for di way im challenge di fourth official afta di ref award Ivory Coast a foul against Osimhen.

26 mins - Tins heat up small wen Ndicka foul Osimhen wit im arm. Both players shout at eachoda. Nigeria dey awarded wit a freekick but e no produce anytin threatening.

23 mins - Lookman dey sandwitched by two Ivory Coast players. Di ref come to im rescue as im blow for foul in favour of Nigeria. From di freekick Ekong bin dey offside according to di ref.

20 mins - Sanusi almost commit ostly mistake. Im backpass header almost fall to Gradel but di ball trickle out for cornerkick.

From di corner Gradel acrobatic kick hit di sidenet.

16 mins - Di Super Eagles need to calm down and play dia game, so far na so so fouls dem dey commit. Six fouls already for Nigeria, Ivory don commit one.

13 mins - Ivory Coast win anoda corner as Ola Aina clear Gradel cross. Nigeria head di ball clear but e fall for Seko Fofana wey waya im shot straight into Nwabali hands.

11 mins - From di freekick Bassey head di ball clear from danger.

9 mins - Bassey and Kessie go toe-to-toe before di defender bring down Kessie. Freekick to Ivory Coast from just outside Nigeria penalty area.

7 mins - Phewww...Nigeria breathe sigh of relief as Simon Adingra left wing cross just past everyone inside di Nigeria penalty box go out of play.

Seconds later Adingra blaze a shot over di bar. Good start by di host.

6 mins - Ivory Coast win di first cornerkick of dis match wen Bassey block send di ball go out. Gradel take di corner but Nigeria clear im cross.

3 mins - Calvin Bassey foul on Haller inside Nigeria half make di Ivorian supporters wey full inside di Alassane Ouattara stadium raise dia voice.

Di cross from di freekick dey tame, Nwabali rush out to catch am.

1 mins - Di 2023 Africa Cup of Nations final don start.

Ademola Lookman get di game underway for Nigeria wey wear dia traditional green jersey.

Nigeria 0-0 Ivory Coast

Nigeria vs Ivory Coast lineup

Nigeria XI: Nwabali, Aina, Ajayi, Troost-Ekong, Bassey, Sanusi, Onyeka, Iwobi, Chukwueze, Lookman, Osimhen

Ivory Coast XI: Y. Fofana, Aurier, Kossounou, Ndicka, Konan, Seri, Kessie, S. Fofana, Gradel, Adingra, Haller