Family confirm singer Mohbad death as Olamide, Tacha, odas react

Mohbad

Wia dis foto come from, @IAMMohbad/Instagram

Di management of Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad don confirm di death of di ogbonge artiste.

Dem confirm Mohbad death through one statement wey dem share through di artiste official Twitter page, @iammohbad_.

"Na wit great sadness we confirm di passing of Promise Oladimeji Aloba PK/A Mohbad (Imole) today, di 12th of September, 2023," di statement tok.

Dis dey come afta ogbonge musician and record label YBNL CEO Olamide Adedeji wey many pipo sabi as Olamide bin react to di tori wey dey fly up and down about Mohbad death.

Na on Tuesday evening, tori begin trend on social media say di Nigerian artiste, don die.

Di Nigerian rapper and music producer, Olamide bin post for X say “Damn! Mohbad" and add heartbreak emoji. E also post say "Dis life".

Dis na afta tori of di death of di 27-year-old begin spread for Twitter.

Reality TV star Tacha also post about di tori.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

"Mohbad na light until di veri end, and as we mourn di loss of di brightness im carri, di family tank you for your love and prayers, and ask say make you continue to respect dia privacy during dis difficult time.

"Imole don finally dey at peace," di statement add.

Plenty of Mohbad fans, oda musicians and Nigerians don dey react to di tori of im death as dem mourn and send tribute on social media.

One of im colleagues, Emeka Akumefule aka Blaqbonez post on X say, "RIP Mohbad, may you find peace."

Mohbad bin dey under Naira Marley “Marlian Records” but e comot di label for 2022.

E popular for im hit songs wey include Ponmo, Feel Good, and KPK (Ko Por Ke) wit Rexxie wey dem nominate three times for 2022 Headies awards.

Screenshot of Olamide

Wia dis foto come from, @Olamide/Twitter

Wetin we call dis foto, Screenshot of Olamide reaction

Wetin to sabi about Mohbad

Mohbad

Wia dis foto come from, @Mohbad/Instagram

Mohbad na one of Nigeria rising musicians. Dem born am for Lagos State, southwest Nigeria for June 1996.

Di singer bin marry Nigerian woman simply identified as Wunmi and dem get one son togeda named Liam.

E bin sign under Naira Marley “Marlian Records” but e comot di label for 2022 in di middle of some controversies.

For inside one recent interview e do wit former Reality TV star Tacha wey also be radio host, Mohbad bin tok about im relationship wit Naira Marley.

Tacha share clips from di interview few hours afta tori of im death break.

E tok for di interview say, “ We just split from Marlian music to Imolenization, we just wan be on our own but e no come easy."

E say e no easy but im dey find im way. E add say dem no dey fight and tins dey cool between dem.

Mohbad bin release im first album, Light EP for 2020. E dey popular for hit singles like Ponmo, Feel Good and Ko Por Ke wit Rexxie.

E also don do collabo wit artiste like Bella Shmurda, Small Doctor, Zlatan, among odas.