Meet di contestants for Miss universe Nigeria 2024

Contestants Miss Universe Nigeria 2024

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Read am in 7 mins

25 beauty queens from across various states go compete for di Miss Universe Nigeria pageant dis August.

Chidimma Adetshina, wey quit di Miss South Africa beauty pageant last week sake of nationality wahala, dey among di pipo wey dey compete for dis pageant.

She join di pageant afta she accept invitation from di organizers.

Di model father na Nigerian while her mama get Mozambican roots but dem born her for South Africa.

Posting on Instagram on August 8, she say I make di “difficult decision” to quit di contest to protect di “safety and wellbeing of my family and me.”

One day afta Adetshina announce her withdrawal from di Miss South Africa pageant, na im di organizers of Miss Universe Nigeria invite her to compete.

Dem say, “na opportunity to represent her father native land for international stage” and dem add say her “journey for di world of pageantry neva end.”

Miss Universe Nigeria say di koko of di pagent na to provide platform for Nigerian women to showcase dia beauty, intelligence and cultural pride to di world.

Ugochi I hezue di reigning Miss Universe 2023 go crown her successor for di grand finale for August 31.

If Adetshina win Miss Universe Nigeria, she go represent di nation and she go jam Miss Le Roux for Miss Universe competition wey go take place for Mexico for November.

DI event go feature more than 80 women from around di world wey dey aspire to become Miss Universe.

Dem go select dem from selected events wey include personal statements, in-depth interviews, evening gown, and swimsuit competitions.

Sheynnis Palacios from Nicaragua na di reigning Miss Universe

For Nigeria, di countdown to di grand finale don start, all eyes go dey on Eko Convention Centre on August 31, na dia dem go crown di next Miss Universe Nigeria.

Voting, na important element of di competition. Audience fit vote for dia for dia favourite contestant as many times as dem want until August 30 wen e go end.

Di top three contestants wit di highest number of fan votes go enta di top 10.

Meet di contestants:

Chioma Nkumeh

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Wetin we call dis foto, Chioma Nkumeh

Chioma Nkumeh wey represent Abia state for South east Nigeria say she wan empower women to become di best version of themselves.

''As pesin we don come out I wan help odas to come too''.


Miss Abuja - Lucille Oputa

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

For Lucille Oputa wey dey represent Abuja she say her plan na to use her crown to empower odas

''I dey stand for every voice wey want pipo to hear and every dream wey wan flourish''.

Happiness Enetak

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Happiness Enetak from Akwa Ibom state say if she win, she go work to improve pipo life wit wetin she call di rise female project.

''I believe in designing pipo life''.

Paula Ezendu

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Anambra main focus na quality health for everybody.

''Dem say di universe dey listen to stubborn pipo heart but for me resilient pipo heart go command di universe to listen''.

Fortune Kurobo

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Fortune Kurobo from Bayelsa state south-south Nigeria say she wan improve di quality of life of women and girls.

''I dey passionate about women reproductive health issues''.

- Joy Omanibe

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Joy Omanibe, wey be Miss Benue na strong campaigner for education and health.

''I go amplify my advocacy wey dey focus on education and healthcare for children wey dey live for rural area''

Emmanuella IGBODOR

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Cross River tok about her passion for humanitarian work.

''I dey committed to make a difference and I wan offer unique perspective of making a difference beyond di beauty aspect''.

Sarah Olotu

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Sarah Olotu wey dey represent Delta say her dream na to represent Nigeria for di world stage.

''My vision na to humbly represent our beloved kontri for a global stage as di Miss Universe platform''.

Mother Theresa Orji

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Mother Theresa Orji wey dey represent Ebonyi believe say she get strong chance to win di crown.

''I dey confident say I go win and in turn I go use my platform to advocate for courses wey dey personal and close to my heart''

Edeifo Aikhuele

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Edo say she get interest for children, health care and education.

''I promise to kotinu to serve our great nation through advocacy for children, health care as well as dia education.''

- Esther Gabriel

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Esther Gabriel wey dey represent Ekiti tok about her passion for girl child education.

''I wan use di Miss Universe platform to campaign for courses wey I dey passionate about especially di one wey get to do wit girl child education''.

Uchechi Uchenna

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Uchechi Uchenna from Enugu say she go like focus on mental health and education for less privilege children.

''If I win I go focus on my personal advocacy wey be mental health and education for less under privilege children''.

Queeneth Igbokwe

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Queeneth Igbokwe wey dey represent Imo say she wan help women wey dey suffer from domestic violence come out of dia relationship.

''My vision na to help women wey be victims of domestic violence leave di relationship bifor dem die inside, I intend to provide financial and mental support for dem to regain dia confidence to move forward .''

Sophia Nelson

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Kaduna say her passion na to help women through skill acquisition to get work, so dem fit reduce di level of unemployment.

‘’Wit di crown I go fit push my plan on a bigger scale’’.

Zuleihat Oyarazi

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Zuleihat Oyarazi wey dey represent Kogi say she go fulfil her dream if she win Miss universe.

''I go fufill my dream of becoming di ambassador of strength for di coming generation and I go bring back di Miss Universe crown home''.

Ufa Dania

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Ufa Dania Ufa from Kwara plan to create impact among young pipo if she win.

‘’I come hia to champion wetin mata, empower odas and make impact and create a ripple effect of positive change wey go, go far beyond di pageant realm and enta inside di community’’.

Favour John

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Lagos say she wan inspire pipo through her journey.

‘’I wan inspire pipo minds, impact lives and remind young pipo to believe in dia self and ability’’.

Priscillia Umehea

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Niger Priscillia Umehea touch on her mindset going into to di competition.

‘’I get positive impact for dis world’’.

Deborah Anosike

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Ogun say she go focus on project wey go improve di quality of life of pipo.

‘’I go create platform wey go make schools to dey available for children and … empowerment for women for Nigeria’’

Peace Ayegbidun

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Peace Ayevibun na fashion designer wey dey represent Ondo she say she wan inspire women to dream big.

''I be living proof say women fit dey strong, beautiful, resilient and do business too''.

Ifunanya Nledo

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Osun, Ifunanya Nledo main focus na to fly Nigeria flag.

‘’I wan represent Nigeria internationally’’.

- Elizebeth Salawu

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Elizabeth Salawu wey dey represent Oyo, say she go campaign for mental health if she win.

‘’I go use fitness and technology to create society wia we go prioritize mental health’’.

Chioma Ogbona

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Miss Plateau, plan to use di Miss Universe Nigeria organisation to give back and impact as many lives as possible for society.

‘’I plan to give back wit my foundation COCF’’.

 Nyekachi Douglas

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Nyekachi Douglas wey dey represent Rivers for south – south say she wan bring back di glory wey pageants bin get bifor for di kontri.

‘’I wan bring back di focus on pageants for Nigeria to wetin e suppose focus on, wey be about advocacy’’.

Chidimma Adetshina

Wia dis foto come from, Miss Universe Nigeria

Chidimma Adetshina wey go represent Taraba state say she go campaign for diversity wit di platform if she win.

''As woman we don face adversity and I wan use my voice and my story along wit Miss Universe Nigeria platform to promote inclusion and acceptance and I also wan educate pipo on di power of diversity to build a strong community wey go benefit everybody.''