'Na dia loss' - South African president hit back at Trump decision to skip G20 summit

A smiling South African president Cyril Ramaphosa for di event

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, President Cyril Ramaphosa say di US go lose out as dem skip di G20 summit
    • Author, Khanyisile Ngcobo
    • Reporting from, Johannesburg
  • Read am in 3 mins

South Africa President Cyril Ramaphosa say "boycott politics no dey work" as e hit back at US President Donald Trump decision to skip di G20 leaders summit for Johannesburg later dis month.

Trump say no US official go attend di gathering sake of di wide claims say dem dey persecute white pipo for South Africa.

Wen e dey speak outside parliament, Ramaphosa say di US "absence na dia loss" and say di boycott no go stop dem from doing di meeting, according to di AFP news agency.

E add say di US dey "give up di veri important role wey dem suppose dey play as di biggest economy for di world".

Di G20 summit dey hold between 22-23 November but for post on social media, Trump say na "total disgrace" say South Africa dey host am.

Trump bin earlier say South Africa no suppose dey for G20 at all, and say e go send Vice-President JD Vance, instead make e attend imsef.

Den ova di weekend, e double down on im claims say "Afrikaners [pipo wey be descendants from Dutch settlers, and also French and German immigrants] dey kpai and slaughtered, and dem dey illegally take ova dia land and farms".

"No US govment official go attend as long as dis human rights abuse dey kontinu," e add.

Trump don previously say while e dey try stop di number of refugees wey di US dey accept, dem go welcome Afrikaners.

Ramaphosa say "boycotting no dey achieve anytin of great impact, becos dem go take decisions wey go move di various issues ahead", AFP report.

South Africa na di current chair of di G20 grouping of di world largest economies.

Di forthcoming summit go mark di first time e dey take place on African soil.

Evri year, different member state hold di G20 presidency and set di agenda for di leaders summit, wia dem go discuss di major economic issues of di day - wit di US due to take ova from South Africa.

Trump no be di only leader wey wan skip di G20. Im close ally, Argentinian President Javier Milei, don also indicate say e no go attend but go send im Foreign Minister Pablo Quirno instead, AFP report.

South Africa govment say dat di claims of a white genocide dey "widely discredited and unsupported by reliable evidence".

E also say dat no white farmers wey dem don take dia lands wey dem no give compensation.

Wetin be G20?

Di G20 - or Group of Twenty - na club of kontris wey dey meet, discuss plans for world economy.

Between dem, G20 kontris get 85% of di world economic activities and 75% of world trade. Dem get two-thirds of di world population.

Di members na European Union, Argentina, Australia, Brazil, Canada, China, France, Germany, India, Indonesia, Italy, Japan, Mexico, Russia, Saudi Arabia, South Africa, South Korea, Turkey, UK and US.

Dem dey always invite Spain as a guest.

Dis year, Nigeria President Bola Tinubu dey attend on di special invitation of Indian Prime Minister, Narendra Modi.

One smaller group from di G20 kontris dey meet as G7.