Kwam 1 tell Nigerians sorry afta airport drama wit ValueJet

Nigerian musician Wasiu Ayinde Marshal alias Kwam 1 don tok sorry on top di mata wey happun for airport on Tuesday.
For video statement wey im make for im official Instagram handle, K1 De Ultimate, call di incident "regrettable" bicos e don contribute most of im life, ova di past 50 years to di growth and development of Nigeria in terms of arts and culture.
E say, "I accept responsibility, to Mr President, di kontri, di honourable Minister of Aviation, di FAAN, di NCAA and my fans worldwide, to please forgive my behaviour."
Kwam 1 give reason for im behaviour as say e pour water inside im cup for lounge bicos im doctor recommend am say e dey dehydrated.
E follow dis one wit asking for apology from di president, aviation minister, pilot, airline, airline staff, passengers and im fans for wetin happun.
Already, di gbas gbos wey bin occur between Nigerian musician Kwam 1 and one of di kontri local airline, ValueJet, dey make many reason wetin be di law concerning dis kain mata.
Di airline bin allege say King Wasiu Ayinde Marshal (K1 De Ultimate) carry alcohol wan enta, action wey be say dey against di law.
E no end dia, e also claim say Oga K1 block di plane, no allow am move, unto say dem no allow am enta.
But K1 insist say no be alcohol im bin carry, say na water im carry for container. Sometin wey be say e also dey against di law to carry water wey 100ml plenty enta plane.
Di mata cause kasala sotey di Nigeria Civil Aviation Authority petition Attorney General of di Federation, plus di Inspector General of Police make dem torchlight di mata.
Aviation authority also give order make Airline Operators of Nigeria add K1 to dia No-Fly list until dem finish dia investigate.
Di Nigeria Civil Aviation Authority get laws wey dey guide how passengers dey take relate wit aviation crew dem so dat tins go move smoothly.
Dis laws dey related to many different aspect of passengers trip from flying to landing.
Di Civil Aviation Act 2022 say, any pesin wey wan carry alcohol, aerosol and gel enta plane must to carry am inside container wey no big pass 100ml.
In fact, passenger wey dey travel by plane no get any business to carry water follow body becos, enough water dey inside plane and na free, dem no dey sell am.
E no stop dia o, dem must to put am inside transparent plastic wey dem must to submit to di cabin crew to check am before dem go fit carry am enta.
Again, Section 45(1) Civil Aviation Act of 2022 say make any passenger wey wan enta plane first surrender im sef plus im load for screening and approval.
If any pesin fail to obey di dis laws, authorities go sama am fine of at least 500 thousand naira ($326).
Section 75 of the Civil Aviation Act 2022 Anybody wey carry imsef waka enta aerodome wit out permit go hear am.
Aerodome na anywia wia plane fit takeoff, departure or move. If you enta dis least 500 thousand naira go comot from your pocket, or at least six months imprisonment or both.
If you wan try seize or control di plane by intimidation or threat , even if na play you dey paly say you want control di plane you don commit hijacking be dat.
Di punishment according to Section 83 of di Civil Aviation Act 2022, na very simple one, if guilty, you go pay at least 25 million naira ($16,319) fine or chill for prison for di rest of your life.
Di pilot sef get im own laws wey e must to obey for tins to flow well for everybody.
Section 81 of Civil Aviation Act 2022: Wia dem operate aircraft in way wey fit cause danger for pesin, dat pilot don commit, and e go collect fine of at least two million naira or two years in prison or di two.
Any passenger wey assault, intimidation or interference wit any crew as dem dey do dia duty, dis include wey dem say off your fone, but you refuse out am for airplane mode, if dem catch you, Section 85 say na 200 thousand naira go comot from your pocket, or dem sama you two months for prison.










