Kemi Badenoch tok how she make dem expel student as teenager for Nigeria

Kemi Badenoch dey wia blue cloth and tok for front of podium wit red branded background

Wia dis foto come from, Dan Kitwood/Getty Images

Read am in 5 mins

UK Tory leader, Kemi Badenoch don tok how she bin get one student wey bin dey cheat for exam expelled, as she bin dey write wen she dey secondary school.

For interview wey she do wit BBC, Madam Badenoch reveal say, "I bin dey di tattletale for class wey dey put oda pikin dem in trouble bicos even dat time I hate cheating."

She reveal say she bin wan dey as first in her class and she bin dey do di work so she bin no want make pesin wey dey do copy-copy come take di score from am.

She tok say, "I remember say e get dis day, I bin dey around 14 or 15, I tanda for middle of dis exam and hala say, 'e dey cheat' and dem expel di boy comot from school las-las and nobodi bin praise me for am even though I bin dey relatively popular for school".

Dis na as she identify Nigeria as low trust society, wia pipo tink say e dey okay to cheat di system bicos dem dey very diverse and her parents no cheat di system so dem miss out on a lot of money.

She say, "pipo go offer my mama money so dia pikin go fit go university, but she no go do am as pipo around us dey enrich demselves, so wen evritin sup, e mean say we lose plenti money so e make me hate pipo wey dey cheat di system".

Na inside dis interview wey she run wit Amol Rajan na im di Tori leader download informate as to how her childhood for Nigeria shape her politics and character.

She tok for di interview say she bin lose her faith in God but she still reason hersef say she be "cultural Christian" and she tok about how some teachers for UK bin no get ambition for black pikin dem for di 1990s.

Dem born Badenoch for London for 1980 but she grow for Nigeria and US wia her mama bin dey teach.

She go back UK wen she be 16 wen she live wit family friend bicos of how di political and economic situation for Nigeria dey bad dey go.

She tell Rajan say she bin really wan go back London.

Last week, Badenoch say she no be Nigerian again o! Dis comment ginger strong reaction for Nigeria as some political figures accuse am say she dey continually paint di kontri bad.

Badenoch bin study for her A-levels for college for south London as she dey work for McDonald and odas.

For her interview, she tok about di "poverty of low expectations" wey she say she face for college wen she say dem dey point black pikin dem make dem run vocational qualifications instead of A-levels and say dem bin dey discouraged from applying to go to Oxford and Cambridge.

Badenoch stress say no be all her teachers show dis kain behaviours and she no tink say dem dey racist but say dem "tink say dem bin dey helpful" by lowering expectations.

Di BBC son follow di pesin wey be principal of Badenoch colleage wen she dey go dia and e say di college dey "try to do di best dem fit for everi student no mata dia background" and di Tory leader comment of low expectations "just sound like rhetoric to ginger her political tori".

When Rajan use am ask Badenoch, she tok say no be just political tok-tok and add say, "if pipo deny say dis tins dey happun, we no go eva fix am".

She argue say no be just wahala for black pikin say, "plenti white working class pikin dem get dis problem wia teachers say, 'well you come from di kain family wia nobodi really wan do anytin. We no go push you. E too hard, e no worth am'. Dat no dey right."

'I bin reject God'

Wetin we call dis Video, Watch: Kemi Badenoch say dem "no praise am" say she accuse fellow student of cheating

Badenoch wey go school for Sussex University to get degree for computer engineering work for for finance and IT bifor she go politics. She marry banker Hamish Badenoch for 2012 and dem get three pikin.

For her BBC interview, she tok about how proud her GP papa, Femi Adegoke bin dey of her wen she bicom MP for 2017.

Wen e bin dey die of brain tumour for 2022, Badenoch tok say, "e cry bicos e know say e go die. E say, 'I know say you dey go all di way and I no go dey to see am' and dat bin dey veri sad."

She also tok about how she lose her faith in God afta she watch di coverage of id Austrian man Josef Fritzl wey bin keep im daughter captive for 24 years for dungeon wey im buld under im house.

Badenoch wey her grandpapa from her mama side na Methodist minister say, "I no fit to stop to dey read dis tori. I read how she dey pray evri day to dey rescued.

"And I bin tink am say, I bin dey pray for all kain yeye tins and my prayers bin dey answered. I bin dey pray for good grades, make my hair grow longer and I go pray say make di bus dey on time so I no go miss sometin.

"E be like, why those prayers bin dey answered, and not dis owman prayers? E be pesin just off candle."

But she add say, "I reject God but I no reject Christianity. SO I fit call myself say I be cultural Christian."

Since Badenoch bicom dia leader for November last year, di Conservatives don lose control of 10 local authorites to Nigel Farage Reform UK and don drop to third or fourth place for national opinon polls.

She bin repeat say make pipo abeg, get "patience" say she know say, "di work of opposition leader nust to hard bifro e bicom easier".

"I be pesin wey pipo don try cancel, and I don alwats succeed and I believe say I fit do am wit di Conservative Party."