First day of Ramadan announced as dem sight moon for Saudi Arabia

Muslims for prayer line

Wia dis foto come from, Emmanuel Osodi/Anadolu Agency via Getty Images

Read am in 3 mins

Dem don sight di crescent moon for Saudi Arabi to signify di start of di start of fasting for di Muslim holy month of Ramadan.

Di first day of Ramadan go now be Wednesday 18 February 2026.

Ramadan dey follow di Islamic calendar, wey dey start wit di sighting of di crescent moon.

Islamic kontris and odas like Nigeria wey get high population of Muslims dey depend on testimony of pipo wey sight di moon to know wen di month start.

For Saudi Arabia, dem sight di Crescent of Ramadan 1447/2026 today Tuesday 17 February 2026.

"Taraweeh prayers go begin for di Two Holy Mosques afta Isha prayers," di Holy Mosque tok.

For Nigeria, di first day of fasting for di Muslim holy month of Ramadan and oda African kontris go be either Wednesday, February 18 or Thursday, February 19, depending on weda dem sight di new moon.

Muslims go observe fasting for di holy month for 29 or 30 days based on di Islamic Lunar calendar.

During di month of Ramadan, Muslims no go chop or drink during di hours of daylight.

Pikin dem no dey expected to fast until dem don mature.

For di Muslims, Ramadan na time to get close to God as na time through serious prayer and reflection.

How Ramadan be?

Most Muslims dey fast between dawn and sunset. Fasting dey allow Muslims to devote demselves to dia faith.

E dey believed say e go teach self-discipline and remind dem of di suffering of di poor.

However, pikins, pregnant women, elderly pipo and those wey dey sick or dey travel no need to fast.

During Ramadan, e dey common to chop one meal (aka sahoor), just bifo sunrise and anoda one (aka iftar), directly afta sunset.

Almost all Muslims try to give up bad habits during Ramadan.

As na time for prayer and good deeds. Dem dey try to spend time wit family and friends and help pipo wey dey in need

Five tins you no suppose do during Ramadan?

Here na some tins wey you no suppose do and must run away from during fasting.

  • No food/water during fasting period: Fasting na di most significant part of Ramadan, dat na why you need do away from eating and drinking between dawn and dusk.
  • No keep malice: Ramadan na all about forgiveness, wey be why you no suppose hold rancour against anybodi.
  • No chew gum: During Ramadan, e dey best make pesin no chew gum or smoke.
  • No listen to loud music/songs: Respect di view of those wey dey fasting or pray during dis holy period.
  • No waste time: Ramadan be one pious period, and e dey good to try use time wella to pray to Allah and nurture discipline.