Nigerian Senate list five reasons dem suspend Natasha Akpoti for six months

Wia dis foto come from, @natashaakpoti/Instagram
Di Nigerian Senate don give di reasons why dem suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan for six months.
According to di Senate, di suspension no get anytin to do wit sexual harassment allegation as some tori pipo don report.
For statement wey Senate leader Opeyemi Bamidele release on Saturday 8 March, di upper chamber say na becos of misconduct and indiscipline dem suspend Madam Akpoti-Uduaghan.
Di Senate tok say di decision come from di Committee of di Whole Senate afta di Senate Committee on Ethics and Privileges find say she violate Senate Rules.
Here na di five reasons wey di Senate give:
- She no gree sidon for her assigned seat: DI Nigerian Senate say for di plenary session on 25 February 2025, she refuse to sidon for di place dem give am, even after di Minority Leader and oda ranking senators beg am.
- She tok witout recognition: Di statement say she bin tok for Senate witout di presiding officer giving her permission, wey be "clear violation of Senate practices and procedures".
- She behave unruly and disrupt Senate proceedings: Di Senate say she no allow tins go smoothly during proceedings.
- She abuse and disrespect Senate leadership: Dem say she make statements wey no dey respectful to di Senate leaders.
- She ignore summons from Senate Committee on Ethics and Privileges: Di Senate tok say dem call am make she come explain her actions, but she refuse to show face.
Di Senate insist say di suspension na strictly disciplinary action based on misconduct.
"Dis actions bin represent direct challenge to di Authority of di Senate and a violation of di Senate Standing Orders 2023 (As Amended) wey govern di business of di Senate and di conduct of im members.
"Di disciplinary measure bin, therefore, dey necessary and justified to restore order and uphold di integrity of di Senate as di kontri foremost democratic institution," di statement tok.
Senator Opeyemi tok say di media no suppose dey spread false information say dem suspend her sake of sexual harassment allegations.
Who be Natasha Akpoti-Uduaghan?

Wia dis foto come from, @Natasha H Akpoti/ Facebook
Natasha Akpoti na member of di Peoples Democratic Party and senator wey dey represent Kogi Central.
She be di second of four children and di only daughter of a Nigerian papa and a Ukrainian mama.
Akpoti na active figure for Nigerian politics, especially for Kogi State, north central Nigeria.
She bin contest for di 2019 Kogi Central senatorial election under di platform of di Social Democratic Party but lose to Yakubu Oseni of di All Progressives Congress (APC).
For 2023, she run again for di same seat under PDP and tribunal declare am winner afta she initially lose to Abubakar Sadiku-Ohere of di APC.
Akpoti political journey don dey marked by legal battles, controversies, advocacy for industrial revival, and women participation for politics.










