You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin Caf, Fifa dey do about Morocco vs Senegal Afcon final drama?
Di confederation of African football (Caf) don condemn di kasala wey happun during di Afcon final between host nation Morocco and Senegal on 18 January 2025.
Chaos breakout for di last minutes for dat game afta referee and VAR give penalty to Morocco for foul on Brahim Diaz.
Di game scata for more than 10 minutes as Senegal players boycott di game wey dem waka comot di park.
Senegal players vex sake of di centre referee blow whistle for foul inside di Morocco box bifor Senegal score dia goal.
Sake of di ref already bin blow di whistle, di VAR no fit check di incident – but Senegal players and coaches no gree.
Al Nassr forward and former Liverpool player Sadio Mane call out his teammates to return to di park and continue di game.
Youssef En-Nesyri wey be di penalty taker carry di ball give Brahim Diaz wey bin get five goals for di tournament.
But wit di chance to win dia next Afcon title in 50 years, Brahim Diaz try di Panenka penalty wey Edouard Mendy save di ball.
Senegal bin go ahead to score di winning goal for extra time thru Pape Gueye to break di hearts of Morocco players and fans.
Caf and Fifa react to di chaos
Na so Caf announce say dem dey chook eye for di videos from di game to act against players and officials wey scata di game for di last minute.
Caf say "we condemn di unacceptable behaviour of some players and officials during di final – Caf no dey support behaviour like dat especially those wey dey target di refereeing team or match organizers."
"Caf dey review all di footage wey we go refer di mata to sabi pipo for act against di pipo wey go dey guilty."
Na so Fifa president Gianni Infantino wey watch di game for di stadium also 'condemn some Senegal players for di unacceptable scenes" wey overshadow di final.
Infantino tok inside one statement to AFP say "we strongly condemn dis behaviour of some Senegal players and technical staff members."
"Na unacceptable to comot di park like dat wey equally violence no dey tolerated for our sport; e just no be right."
Senegal coach apologize for di 'boycott'
Senegal coach Pape Thiaw wey lead his kontri to dia second Afcon don apologize say he ask his players to boycott di game afta dem award late penalty to Morocco.
Afta di game, coach Pape Thiaw tok for BeIN sports interview say "we no gree wit di decision, dat be why we do dat tin; I no like how I bin act."
"I tok di players to leave di pitch dat time sake of I don vex, I apologize to di world of football."
Thiaw add say "once I bin calm down wey I tink about di tin, I ask di players to go back to di pitch wey we all sabi wetin happun afta dat."
Meanwhile French manager Claude Leroy confam afta di game say Sadio Mane bin ask am for advice for di touchline during di confusion.
"Sadio ask me wetin I go do if I dey inside im shoes, wey I tok am say I go resume di game, sake of you neva sabi wetin go happun afta dat."
Las las Mane call his teammates wey di game continue – bifor di Teranga lions eventually win di game; dia second Afcon for dia history.
Sadio Mane also win di player of di tournament; wit dat, di 33-year-old player now win two Afcons, wey he be two-time Caf player of di year.
Yassine Bono from Morocco win goalkeeper of di tournament, Brahim Diaz win top scorer wit five goals.