Five key tins wey happun for Afcon 2025

Read am in 7 mins

Di 2025 Africa Cup of Nations don end but di almost one month long tournament wey happun for Morocco still dey cause tok-tok.

Senegal win dia second Afcon title afta kasala wey almost see dem almost abandon di match.

Dis reactions from fans and football lovers na sake of some tins wey happun for di tournament.

Afcon 2025 witness alleged referee bias and poor officiating, violence on di pitch between Nigeria and Algeria for di quarterfinals, tensed match between Nigeria and Morocco and walk-out for di finals between hosts Morocco and Senegal.

Cameroon Football President, Samuel Eto'o Fils also chop match ban and fine sake of di way e react to referee decision wey no sweet im belle.

Anoda part na how big names for football miss important penalty and di awards wey kontris and players later win as di tournament end.

Make we chook eye inside dem one by one.

Kasala for Senegal vs Morocco final

Di kasala wey happun during di final wen di centre referee Jean Jacques Ndala award stoppage time penalty to Morocco.

Di referee give penalty for di 98th minute afta di VAR advise am to watch di monitor to confam El Hadji Malick Diouf challenge of Brahim Diaz of Morocco.

Dis dey come afta e bin don cancel goal wey Senegal score sake of foul wey happun for di buildup to di goal.

Dis decision make Senegal coach vex as e tell di team to comot from di field. Di players and technical crew para well-well sotay dem vex comot from pitch say dem no dey play again.

Dem later come out to play and Brahim Diaz of Morocco miss di penalty as di ball in 'Pamela' spot kick land for Senegal goalkeeper Mendy hand.

For Extra time, Pape Gueye score di winning goal inside di fourth minute of extra time.

For post-match conference, Morocoo coach Walid Regragui say di actions of Senegal dey "shameful" and e no "honour Africa"

Fifa President, Gianni Infantino don strongly condemn di "ugly scenes" inside post for Instagram.

Meanwhile di coach of Senegal no fit tok for post-match conference because dem cancel am sake of di kasala wey burst for field.

Caf for statement wey dem release on Monday 19 January say dem go review wetin happun and take disciplinary action against Senegal or Morocco if dem find any of dem guilty.

Nigeria and Algeria players kwanta for quarterfinal

For di quarterfinal match between Nigeria and Algeria anoda kasala bin happun afta Nigeria beat Algeria 2-0. Nigeria bin progress to di semifinal while Algeria journey end.

Dis win make tempers rise as Algerian players cause kasala for pitch as dem begin argue wit Nigeria players.

Small time dem begin push each oda before match officials and di technical crew intervene.

Dem later calm down ans di players and evribody waka enta dressing room.

Nigeria also face hard time against Morocco as pipo allege say Caf do evritin to frustrate Nigeria so dat Morocco go enta di finals.

Football fans begin complain from wen Caf bin name Ghanaian referee and oda officials wey go officiate di Nigeria vs Morocco semifinal clash.

Dem even accuse di Ghanian referee Daniel Nii Ayi Laryea of poor officiating.

But Caf don tok say dem go chook eye for all di controversies and accusations against referees and oda officials for di 2025 Afcon.

Ogbonge players wey miss 'important' penalty kick

Penalty kicks plenti well-well for di 2025 Afcon sake of say many matches enta extra time from di quarterfinals.

Dem need dis penaties to decide di winner of dis matches and coaches dey always bring dia best leag to play, but sometimes e no dey go as planned.

Some of di ogbonge players wey miss spot kicks na.

Mohamed Salah - Di Egyptian and Liverpool forward bin step forward to take di first kick against Nigeria but nigeria goalkeeper Stanley Nwabali catch di ball.

Omar Marmoush - Anoda Egyptian player Omar Marmoush miss dia secomd spot kick as Nigeria goalie Stanley Nwabali show imsef again as e save di kick.

Brahim Diaz - Dis ogbonge player dey play fopr Morocco and Real Madrid for Spain. E miss di penalty wey suppose give Morocco dia first title in 50 years. E play 'paneka' kick wey land for Senegal goalkeeper Mendy hand.

For Nigeria team di likes of Samuel Chukwueze, Bruno Onyemachi and Dele Bashiru miss penalties.

Best player awards

One tin wey sweet pipo belle na di Best Player awards wey players dey win for dia kontri sake of dia performance for di tournament.

Sadio Mane of Senegal win di Player of di tournament.

Brahim Diaz of Morocco win di Golden Boot as top scorer wit fiove goals.

Yassine Bonou of Morocco win di Golden Glove for di best Goalkeeper

Morocco win di Fair play award

Third place - Nigeria [Bronze]

Second - Morocco [Silver]

Senegal - Winners [Gold]

Samuel Eto'o chop Caf ban and sanction

Sake of all di complains and accusation of poor officiating, di President of Cameroon Football Federation chop sanction from Caf

Caf say dem sama Et'o ban and fine sake of allegations of misconduct during di Africa Cup of Nations, Afcon, competition.

For statement, Caf say dem find Mr. Eto'o guilty of violating di principles of sportsmanship, during di quarterfinal match between Cameroon and Morocco.

For di match wey bin hapun on January 9, tori be say di Fecafoot president bin dey make angry gesture ova some of di decisions wey di officiating referee make.

Cameroon lose di match 2-0 to hosts Morocco.

Meanwhile, Fecafoot don reject Caf decision, dem describe di process as one wey dey "raises serious reservations about di fundamental requirements of a fair trial."

Di federation express support for dia president inside one statement on Wednesday, wia dem suggest say Mr. Eto'o go appeal di sanction.

Since im enta office as head of Cameroon Football Federation for 2021, Eto'o don enta several controversy.

Im bin don face accusations of improper conduct, poor management, wit some football stakeholders wey dey also complain of serious irregularities within Fecafoot.

Di 44-year-old former striker don reject dis allegations many times.