You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Ghana authorities dey gbab syndicates wey dey lure Nigerians to di kontri for scamming jobs
Authorities for Ghana dey pursue suspected cybercriminals (aka Yahoo-Yahoo pipo) wey dey operate for different parts of di kontri.
Dis pipo dey scam many pipo wey dem dey use different strategy to collect money from pipo wey odas dey promise pipo jobs wey no dey even exist.
For di latest crackdown, officers from di cyber security authority (CSA) wit collaboration from di police and odas, gbab 53 suspects from East Legon hills, Afienya, Kwabenya, Weija and Tuba - wey dem rescue 44 pipo wey di kontri communication minister describe as "victims wey dem lure to di kontri to do Yahoo-Yahoo business".
"Di operation wey last for two days, find 62 laptops, 52 mobile phones wit two pump-action guns," Samuel Nartey George, di minister write for im social media pages.
E add say "di cyber security authority pick up nine pipo wey dem suspect to be ringleaders wey all di 53 suspects be Nigerians".
E dey common now to find foreigners for Ghana wey oda foreigners bin deceive dem to enta di kontri for beta jobs.
Wen dis pipo finally enta di kontri, dem go put dem inside one house, seize dia travel document and force dem to do Yahoo-Yahoo.
Di cyber security authority say from dia operation, most of dis foreigners dey engage for mobile money fraud, romance scam, business email compromise, wire fraud among odas – tins wey Interpol describe as worrying for Africa.
Di sector minister add say "dem profile all di pipo wey dem arrest, wey dem hand dem ova to di immigration service as investigation dey continue".
Oda times Ghana authorities pursue 'cyber criminals' for di kontri
27 December 2025 – Di immigration, police and cyber security authority arrest a total of 141 suspects for Tabora and Lashibi. Dem collect 38 laptops, 150 mobile phones wey authorities believe say dem use to commit financial crimes. Dem also arrest di landlord of di house wia di 100 pipo dey stay. Di suspects dey accused of mobile money fraud, romance scam, sextortion and wire fraud. Di suspects dey for police custody wey dem dey assist for investigation.
24 December 2025 - Dem arrest 48 suspects for Dawhenya for di Greater Accra region – 46 males and two females wey be Nigerians linked to cybercrimes like online investment fraud, impersonation and illegal gold trading among odas. During dat operation, dem say dem seize 54 laptops, 39 mobile phones, star link internet device and oda turbonet routers.
13 December 2025 – Di cyber security authority arrest 32 suspects for one operation for Kasoa – Tuba. All di suspects be Nigerian nationals, wia dem seize 31 laptops, 15 mobile phones among odas.
11 December 2025 – Authorities combine to arrest Frederick Kumi aka Abu Trica and two odas for dia role in romance scams wey allegedly defraud US pipo up to $8m. Dis arrest follow indictment by grand jury for di US wey tok say Abu Trica and di oda suspects use AI to fake identity of oda pipo wey dem scam Americans. Dem charge Abu Trica wit conspiracy to commit wire fraud, money laundering among odas, wey Ghana authorities dey work to extradite am to di US to face trial. Dat process still dey underway.
On 30 April, 2025 di circuit court for Achimota sentence two pipo for trafficking two ladies from Nigeria to Ghana to engage for prostitution. Jessica Daniel aka Blessing and Kelvin Johnson aka Alaska lure di victims to enta Ghana say dem go give dem job as domestic servants but las las dem end up for prostitution.
On 29 May 2025 di court jail Nigerian Promise Ebuorbo and four accomplices say dem keep illegal migrants for dia house wey dem involve for cybercrime wey dem dey scam real estate pipo. Promise Ebuorbo chop 12-month prison sentence wit fine.
For 30 July 2025, di district court for Ashaiman jail two Nigerians for 18 months wit hard labour sake of cyber fraud and illegal entry into di kontri. John Moore and Charles Bruce plead guilty to di charge of engaging for yahoo-yahoo and entering Ghana by unapproved border.
Communications minister Samuel Nartey George say dem hand over some of di suspects to di Nigerian law enforcement agencies while odas dey face prosecution for Ghana.
Di kontris Cyber Security Authority and oda agencies dey continue to conduct dis operations to remove cybercriminals, wey dem dey work wit US authorities to arrest high-profile suspects wey dey linked to crimes for di America.
"We go continue to protect Ghana's cyber security image internationally. Di law enforcement agencies go still pursue dis suspects to find dem wherever dem dey," di minister tok.