You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Family wey jaguda pipo wipe out for Kano, police arrest three suspects
Di killing of one woman and her six children for one community for Kano state, Northern Nigeria dey cause fear and panic.
Di incident happun on Friday for Dorayi Chiranchi Quarters for Kano metropolis wia suspected jaguda pipo invade di house and kill seven pipo.
E no clear weda na one pesin or group carry out di killing wey Haruna Bashir, di papa of di house escape.
Di victims na 35-year-old Fatima Abubakar wey be di mama and pikin dem – Maimuna 17 years, Aisha 16, Bashir 13, Abubakar 10, Faruk 7, and Abdussalam wey just be one-year-old plus.
Kano State Police Command say dem day torchlight wetin dem call "di wicked killing of one woman and her six pikin for Dorayi Chiranchi Quarters, Kano Northern Nigeria."
Dis dey inside one press release wey di command tok-tok persin Abdullahi Haruna Kiyawa release on Saturday.
E tok police receive distress call around 12:10pm on January 17, 2026, say attack happun for di house of Haruna Bashir.
Di statement tok say, "Di victims, Fatima Abubakar (35) and her six pikin, na unknown hoodlums attack dem after dem break enter dia house."
Police tok say di attackers use dangerous weapons attack di victims, and dem get serious injuries wey lead to dia death.
As police receive di report, di Commissioner of Police, CP Ibrahim Adamu Bakori, PhD, "immediately mobilize police team led by di Deputy Commissioner of Police in charge of Operations, DCP Lawal Isah Mani, go di scene."
Dem carry di deadi body dem comot and rush dem go Murtala Mohammed Specialist Hospital, Kano, wia doctors confirm say dem don die.
Kano State Police Command also extend condolence to di family of di victims, pipo of Dorayi Chiranchi, and Kano State as a whole.
Reports tok say di hoodlums attack dem wit dangerous weapons afta dem break enter di house for Dorayi Gidan Kwari on Saturday.
Pipo wey dey stay for di area tok say di incident na di most terrible and shocking tin wey dem don ever see.
One resident for di area, wey say make we no call im name, tell BBC News Pidgin say di killing of di whole family don seriously shake di entire community.
"Till now we still dey shock. Nobodi fit explain why dem go kill one man entire family, or who even do am," im tok.
E add say dem carry di bodies of di victims go Murtala Mohammed Specialist Hospital, wia doctors confirm say dem don die.
Governor Yusuf mourns slain Kano woman and her pikins
Kano State Govnor, Abba Kabir Yusuf, don show big sorrow over di brutal killing of one woman and her children for Dorayi Chiranchi area of Kano, describe di incident as "barbaric, senseless and serious attack on human dignity."
Dis one come out for statement wey di tok-tok person to di govnor, Sunusi Bature Dawakin Tofa, release on Saturday.
Di govnor say killing of one mama and her innocent pikin dem "no dey acceptable at all" and promise say im govment no go allow such wicked crime pass witout punishment.