You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria go face worst hunger in 10 years sake of aid cut - Report warn
Di United Nations World Food Programme don warn say thousands of pipo for northeast Nigeria dey face di risk of massive food shortages for di first time in almost a decade.
Dem tok dis one on Friday and add say na aid cuts dey worsen malnutrition across di region.
Di WFP tok say for Borno state alone na about 15,000 pipo dey at risk wit ova 13 million for di Northeast region wey go suffer malnutrition dis year.
Di statement add say kasala, displacement and economic palaca don increase food insecurity ova di years but according to di WFP deputy regional director for West and Central Africa, Serah Longford "di reduced funding wey we see for 2025 don deepen hunger and malnutrition for di area."
Di financial mata from 2025, for Nigeria make WFP to reduce hand for dia nutritional programmes and dis come affect ova 300,000 pikin dem.
E also make di malnutrition levels for many northern states to go down from "serious" to "critical".
Di latest analysis na from di Cadre Harmonisé wey be like di Integrated Food Security Phase Classification (IPC) for West and Central Africa.
Dem dey also estimate say ova three million pipo go face emergency levels of food insecurity for 2026. Dis na double di number from 2020.
Nigeria dey part of di four kontris wey go join to make up 77 percent of di food insecurity numbers. Di oda kontris include Chad Cameroon and Niger.
Di statement tok say, "for Nigeria, WFP go only fit reach 72,000 pipo for February, dis na drop from di 1.3 million pipo wey bin dey assisted for di 2025 lean season".
Meanwhile insecurity for Mali don scata food supply routes for Mali wey make 1.5 million pipo dey face crisis levels of hunger. For Cameroon, ova half a million fit dey removed from aid for coming weeks, according to di statement.
Di WFP tok sat dem need ova $453 million in di next six months so dem go fit to continue dey provide humanitarian assistance across di region.
Madam Longford add say, "to comot di cycle of hunger for future generations, we go need ogbonge shift for 2026. Natoional govments dem and dia partners need to increase investments for preparedness and anticpation and accion and resilience building so dem go fit empower communities".
One of di ways wey di WFP dey work on na land restoration for di Sahel.
Dem reason say sice 2018, WFP and communities don help rehabilitate 300,000 hectares of farmland in five kontris wey go suppoer ova four million pipo in ova 3,400 villages.
WFP programmes for di region, according to di statment dey help to build infrastructiore develoopment, school feeding, nutrition, capacity building and seasonal aid so dependecy on aid go redice.