You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Three reasons why blood dey your poo-poo wey no be colon cancer
- Author, Redacción
- Role, BBC News Mundo
- Read am in 4 mins
E dey very common pass a pipo think am but wen e appear e fit cause big alarm.
Many pipo dey fear wen dem see blood for dia poo-poo and think say dem don get some tin wey dey as serious as colon cancer.
However, e get more common causes behind dis symptom, some more serious dan odas.
Fermín Mearín, director of di digestive system department for Teknon Medical Centre in Spain, explain di most common cause to BBC Mundo:
1. Haemorrhoids or anal fissures: dis usually cause bright red blood to appear afta bowel movement.
"Dis one dey usually show say di bleeding dey come from below, and di cause fit be di anus or rectum," Dr Mearín tok.
Hemorrhoids no dey easy to see wit naked eyes, but dem fit detect wetin dey happun for di anal area through rectal touch and rectoscopy.
Dem fit detect anal fissure through simple check. Na small cut for di anus wey pipo wey e fit affect dey suffer from constipation, and e fit dey painful.
2. Inflammatory bowel disease: di cause of inflammatory lesions in di intestine fit be colitis ulcerosa or Crohn's disease."
'In dis case, in addition to inflammation, diarrhoea and abdominal pain fit dey happun,' Mearín tok. E dey usually affect di colon, although Crohn disease sometimes dey affect di small intestine.
For dis case, di poo-poo go dey between red and dark in colour wit mixed color. "Di more red, di lower di inflammation dey close to di anus," Mearín tok.
3. On di oda side, if di poo-poo dey very black and sticky, e fit mean say di pesin get existence of high bleeding in di stomach.
In dat side, dem go need to go do gastroscopy, make dem check say e no be bleeding ulcer for di stomach area or duodenum.
Most times, blood dey show no mean say e dey serious.
But if di blood dey dark and e dey mixed wit di poo-poo, e fit come from di colon or some oda part of di body.
For dis matter, doctors dey recommend make dem do colonoscopy to check for colon polyps, colon cancer or vascular lesions.
Some kontris get colon cancer screening programmes wey pipo ova certain age dey use to examine.
Dis programs dey use faecal occult blood testing to show if sign of colon cancer dey.
If dem detect blood for patient poo-poo, dem go refer dem for futher testing, e dey make pipo dey worry.
But for many cases, dis distress no really get any reason base on di statistics.
"Pipo dey come to di clinic scared, but most times, dem get harmless conditions," Mearín tok.
Wen pesin wey don pass 50 years or get family history of colon cancer, doctors go choose to perform endoscopy to check di colon condition.
Even though di color of di pesin poo-poo fit help, no forget say wen you chop some certain food e fit affect am.
Black licorice, for example, fit make your poo-poo black. And beetroots or tomatoes fit sometimes make your poo-poo dey reddish.
In any case, anytime wey you see blood inside your poo-poo, e dey important make you rush go see docror to get accurate diagnosis.