You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why bandits don begin attack Kano?
Two sojas and one vigilante member die after di Nigerian Army face off wit bandits for Shanono Local Government Area of Kano State for north west of di kontri.
Inside statement, authorities say di troops led by 3 Brigade Nigerian Army contain di bandits wey bin wan invade communities for di area.
"Following di tip-off on movement of bandits around Ungwan Tudu, Ungwan Tsamiya, Goron Dutse axis of Shanono Local Government Area of Kano State at about 5:00pm on 1 November 2025, di troops of 3 Brigade supported by oda security agencies raid di bandits and push dem out of Shanono resulting in a heavy fire fight."
Reports say di bandits wey land with motorcycles exchange gun fire with di troops wey lead to di deaths of 19 bandits, two sojas and one vigilante member.
All dis dey hapun as reports dey of di spread of bandit attacks into Kano State.
Additionally, further operations are ongoing in the general area as efforts are made to protect vulnerable communities who have been prone to cattle rustling from the bandits. The Nigerian Army urges citizens to remain vigilant and report suspicious activities.
Reports bin don come out about gunmen attack for Shanono and Tsanyawa local government areas for Kano state.
Pipo wey dey live for di villages inside di local governments tok about di panic and sorrow afta di gunmen raid dia communities.
Dem tok say di bandits carry pipo and animals go.
One resident wey no wan make dem mention im name tok say di gunmen enter dia village wit at least 20 motorcycles.
"Wen dem enter, dem stop for one place wey we dey call Central Abuja, from dia dem divide, some go east, some go south and north.
"All di villages wey dey around dat area run for dia lives. Afta small fight wit dem, di bandits come back, dem go house to house, carry two women and one man."
Pipo wey dey live for di towns still tok say no be di first time wey gunmen dey attack dem.
"For dis past week, no day wey dem no attack one village or di oda. Even if dem no come your village, dem go attack one wey near you. Dem carry cows ike 500 in one day wen dem attack."
For Tsanyawa Local Government, anoda resident wey also no wan make we mention im name confirm say di attack happun for im area.
"As we dey now, we dey inside sorrow and small joy. We hear say dem kill plenty of dem and dem also catch some."
Recently, Kano State don dey experience attacks from bandits wey pipo dey suspect say dem dey come from Katsina State wey dey border Kano.
Dis one na new tin and cause of concern for Kano pipo, sake of say normally, dem no dey see bandit wahala for di state for northern Nigeria wey pipo sabi as business state.
Why bandits don dey carry out attacks for Kano?
For one interview wit BBC News Pidgin, Chairman of Shanono Local Government, Abubakar Barau Shanono, tok say plenty reasons dey why bandits don dey focus on Kano now, wey include di peace tok wey dey happun wit bandits for Katsina State.
"We don get report say di peace tok wey hapun wit bandits for Katsina na one of di reasons wey make dem focus on Kano now, wia dem dey attack us steady.
"Di attack wey dem do for Gauran Dutse di day bifor yesterday, dem kill two pipo one soldier and one civil defence officer. And no be di first time, dem don attack us many times" e tok.
E still tok say dem get report say anytime bandits wan cross enter Kano from Katsina to do attack, nobodi dey stop dem bicos of di peace tok wey dem do wit dem.
Chairman Barau add say dem don dey train youths on how to defend demsef and dem don also bring security pipo come di areas wey bandits dey attack.
"We dey train di youths wey dey face dem wen dem come attack.
Di state government don also bring security pipo including soldiers and dey send fighter jets anytime we hear say dem dey come. Dia days don dey numbered."
Meanwhile for di State Security Council meeting wey hapun on Thursday for Government House, Kano, di state govnor emphasize say grassroots intelligence sharing and cooperation between communities and security agencies dey very important.
Dis one dey inside one statement wey the govnor tok-tok person, Sunusi Bature Dawakin Tofa, release on Saturday.
Govnor Yusuf mention Shanono, Tsanyawa, Tudun Wada, Doguwa, and Gwarzo as local government areas wey need special attention bicos dem dey vulnerable to security threats.
E still confirm say im government go continue to maintain peace and stability, and tok say security na di number one priority of the government.
"We must continue to work togeda from di grassroots to di state level to protect lives and property," di govnor tok.
E still sympathize wit residents wey di recent security wahala affect and assure dem say government go continue to protect all di communities for di state.