Why Trump revoke di visas of more dan 100,000 US residents, including student visas

Read am in 3 mins

United States govment don cancel more dan 100,000 visas since President Donald Trump return to office for 2025, as im administration kontinu to crackdown on immigration.

Di US States Department wey announce di informate for statement on dia official X account tok say dos wey dey affected include 8,000 students and 2500 specialised workers.

Also, majority of di visas dem cancel na business and tourist travellers wey overstay dia visas, di statement add.

Di number break record, and e follow President Donald Trump executive order on foreign vetting.

Which pipo visa US revoke and why

US State Department say dem withdraw "thousands" of di visas sake of crimes wey include assault and drunk driving.

According to di statement, about 8,000 students and 2,500 specialized workers lost dia legal status to stay for di US sake of "criminal encounters wit law enforcement". We go kontinu to deport these thugs to keep America safe," di US Department write.

Nearly 500 students lost dia visas for drug possession and distribution and hundreds of foreign workers lost dia visas bicos believe dey say dem dey abuse children, according to one department tok-tok pesin.

Secretary of State Marco Rubio say dem also revoke visas from students wey protest against Israel.

For August, di State Department bin cancel di visas of more dan 6,000 international students.

"Evri single student visa revoked under di Trump Administration happun becos di individual don either break di law or express support for terrorism while in di United States," dem tok.

Among di specialized workers, half of di revocations na based on drunken driving arrests, 30% for assault, battery or confinement charges, and dem cancel di remaining 20% for theft, child abuse, substance abuse and distribution, fraud and embezzlement charges.

For August 2025, Trump administration bin announce say dem dey review all 55 million foreigners wey get valid U.S. visas.

State Department principal deputy tok-tok pesin, Tommy Piggott add say di administration go continue dia aggressive enforcement posture through dia new "continuous vetting centre."

"Di Trump administration go continue to put America first and protect our nation from foreign nationals wey pose a risk to public safety or national security," e tok.

America also don enforce stricter standards for obtaining U.S. visas.

Di State Department bin launch Continuous Vetting Center, wey di aim be to ensure "all foreign nationals on American soil comply wit our laws – plus say di visas of dos wey pose a threat to American citizens dey swiftly revoked", Pigott tok.

For November 2025, di State Department say dem cancel about 80,000 non-immigrant visas since Trump inauguration, for offences wey range from driving under di influence to assault and theft.

Di visa revocations na part of one wider campaign of mass deportations, wey federal agents dey carry out.

Di Department of Homeland Security last month tok say Trump administration don deport more dan 605,000 pipo and 2.5 million odas don self deport.