Morocco 0-0 Senegal Afcon 2025 final live updates

Read am in 6 mins

Di African Cup of Nations don reach im final chapter for Morocco on Sunday as di hosts go jam Senegal in dia hopes to win di title for di first time in 50 years.

Di match wey go happun for di Prince Moulay Abdellah Stadium in Rabat get di African player of di year, Achraf Hakimi as di captain for Morocco.

If dem win e go be di second time wey host kontri dey gbab di title for Afcon, back to back. Ds na afta Ivory Coast gbab am for Abidjan for 2024.

Senegal sef wan show demselves for dis Afcon final as na dia third finals in four competitons.

Dem dey find dia second title afta di first one wey dem sama Egypt for Yaounde on penalty shootout to carry di title for 2022.

From di team side dem don least di 11 players wey go play for id AFCOn trophy

For Senegal na:

  • Edouard Mendy
  • Antoine Mendy
  • Niakhate
  • El Hadji Malick Diouf
  • Camara
  • Idrissa Gueye
  • Iliman Nadiaye
  • Pape Gueye
  • Jackson
  • Mane

For Morocco na:

  • Bounou
  • Hakimi
  • Aguerd
  • Masina
  • Mazraoui
  • Ezzalzouli
  • El Aynaoui
  • Saibari
  • El Khannouss
  • El Kaabi
  • Diaz

First Half

2 mins - Achraf Hakimi win free-kick. Dem dey boo Senegal wen dem dey pass ball

3 mins - Ball wey dem pass go backwards pass di Senegal keeper Edouard Mendy legs put defender comot am bifor e enta.

4 mins - Achraf Hakimi run forward only to jam im team mates.

5 mins - Sadio Mane win early corner for im side afta dem block im cross

6 mins - Almost 1-0 as Senegal corner kick alost enta as Moroccan keeper Yassine Bounou first miss am bifor im adjust block ball wit chest

8 mins - na Senegal dey push pass for dis time as Nicolas Jackson push, Noussair Mazraoui bounce am comot.

10 mins - Moroccan Abde Ezzalzouli see im chance dey blocked my Malik Diouf.

12 mins - Morocco don get goal kick.

14 mins - Morocco don dey do doinds as Ismael Saibari move from midfield as gap open for am at edge of bo only for am to use left leg kick am troway.

16 mins - Iliman Ndiaye dribble Nicolas Jackson only for Antoine Mendy do beta defending work for dia to make am goal kick

20 mins - All Senegal attacks dey pass through Sadio Mane. E don enta midfield to try make sometin happun.

22 mins - Morocco find opening and Ismael Saibari enta one on one until e give di ball to di keeper but e dey wide. Howeva e still dey offside sha.

24 mins -Lamine Camara don gbab di first yellow card of di game afta e dive for di halfway line and enta Neil El Aynaoui.

27 mins - Nicolas Jackson don clear di ball and Sadio Mane don win wide free kick.

28 mins - Lamine Camara go want that free kick back. E smash im cross ova evribodi and go for goal kick.

30 mins - Yassine Bounbou do beta keeping as im head ball wey bin wan go Sadio Mane

34 mins - Morocco no fit use di wide free kick do beta tin and ball don go back to Senegal. Malick Diouf dribble two players to enta midfield.

38 mins - Ahhhh beta save!!!! Nicolas Jackson bin get ogbonge ball give Iliman Ndiayee wey enta one on one wit keeper.

But e no make am as keeper Yassine Bounou quick comot im line and manage comot di ball wit kick.

41 mins - Morocco almost open scoring afta Ismael Saibari spin from defender and sama ogbonge ball. Even though Morocco defender Nayef Aguerd dey free for middle.

45 mins - Four minutes dey added to di end of di first half! Senegal move forward till dem tackle Sadio Mane for di box. Senegal don get corner

45+2 mins - Morocco head Senegal corner comot.

45+2 mins - Morocco don lose possession for dangerous area, all Lamine Camara suppose do na play in Sadio Mane but guy shoot am nad dem block am. Chai!!!

45+4 mins - HALF TIME DON REACH!!!

Line ups

From di team side dem don least di 11 players wey go play for id AFCOn trophy

For Senegal na: Edouard Mendy, Antoine Mendy, Niakhate, El Hadji Malick Diouf, Camara, Idrissa Gueye, Iliman Nadiaye, Pape Gueye, Jackson, Mane

For Morocco na: Bounou, Hakimi, Aguerd, Masina, Mazraoui, Ezzalzouli, El Aynaoui, Saibari, El Khannouss, El Kaabi, Diaz

Dis no go be di first big moment for di Morocco team wey dey headed by Walid Regragui in recent years.

Dis na becos Morooco becom di first kontri from Africa wey go reach World Cup semi-finals wey dem do for 2022.

Dem also jump enta 11 for di world rankings even pass Italy sef.

But dis neva change anytin for dia track record for di African stage as dia only Afcon tilte dem win am for 1976.

In fact dis na di first time wey dem even smell di finals since 2004 wey Ragragui still dey play for di team sef, but dem still loose to Tunisia

Senegal sef wan show demselves for dis Afcon final as na dia third finals in four competitons.

Dem dey find dia second title afta di first one wey dem sama Egypt for Yaounde on penalty shootout to carry di title for 2022.

Di AFP quote Regragui say e tok say, "Senegal go need strong well-well to beat us for house even though dem dey capable."

Senagal reach di final afta dem sama Egypt 1-0 from Sadio Mane at di 78th minute of di game.

As all dis one dey go on di Senegalese Football Federation (FSF) don express "serious concerns" ova di security of di national team afta dem land for Rabat.

Na so fans gada di players lije mad to try take selfies wit dem and even try enta team bus afta dme reach di capital for train on Friday.

For statement, di FSF also complain abot id hotel wia di team dey stay, di number of tickets wey dem give for dia supporters nad say dem no happy say dme give dem trainning pitch for di Morocco team home base.

Di FSF say di "lack of beta security" don put platers and staff "at risk".

Senegal manager Pape Thiaw tok say "wetin happun yesterday no normal. Wit di number wey dey dia , anytin fit happun.

My players for dey in danger. Dat kain tin no suppose happun netween two broda kontris."

Di Confederation of African Football president Patrice Motsepe tok say na di bodi "duty" to Senegal to make sure say dia federation get "all di support and encouragement wey dem need".