Afcon 2025 final: Morocco play Senegal on dia mission break 50 years Afcon record

Hakimi and Sadio Mane as dem dey play ball for different fields wey dme come crop dia pictures togeda wit Hakimi as e dey rep Morocco andMane as e dey rep Senegal

Wia dis foto come from, Ryan Pierse/Getty Images

Read am in 4 mins

Di African Cup of Nations don reach im final chapter for Morocco on Sunday as di hosts go jam Senegal in dia hopes to win di title for di first time in 50 years.

Di match wey go happun for di Prince Moulay Abdellah Stadium in Rabat get di African player of di year, Achraf Hakimi as di captain for Morocco.

If dem win e go be di second time wey host kontri dey gbab di title for Afcon, back to back. Ds na afta Ivory Coast gbab am for Abidjan for 2024.

Dis no go be di first big moment for di Morocco team wey dey headed by Walid Regragui in recent years.

Dis na becos Morooco becom di first kontri from Africa wey go reach World Cup semi-finals wey dem do for 2022.

Dem also jump enta 11 for di world rankings even pass Italy sef.

But dis neva change anytin for dia track record for di African stage as dia only Afcon tilte dem win am for 1976.

In fact dis na di first time wey dem even smell di finals since 2004 wey Ragragui still dey play for di team sef, but dem still loose to Tunisia

Hakimi and Sadio Mane as dem dey play ball for different fields wey dme come crop dia pictures togeda wit Hakimi as e dey rep Morocco andMane as e dey rep Senegal

Wia dis foto come from, Ryan Pierse/Getty Images

Senegal sef wan show demselves for dis Afcon final as na dia third finals in four competitons.

Dem dey find dia second title afta di first one wey dem sama Egypt for Yaounde on penalty shootout to carry di title for 2022.

Di AFP quote Regragui say e tok say, "Senegal go need strong well-well to beat us for house even though dem dey capable."

Senagal reach di final afta dem sama Egypt 1-0 from Sadio Mane at di 78th minute of di game.

As all dis one dey go on di Senegalese Football Federation (FSF) don express "serious concerns" ova di security of di national team afta dem land for Rabat.

Na so fans gada di players lije mad to try take selfies wit dem and even try enta team bus afta dme reach di capital for train on Friday.

For statement, di FSF also complain abot id hotel wia di team dey stay, di number of tickets wey dem give for dia supporters nad say dem no happy say dme give dem trainning pitch for di Morocco team home base.

Di FSF say di "lack of beta security" don put platers and staff "at risk".

Senegal manager Pape Thiaw tok say "wetin happun yesterday no normal. Wit di number wey dey dia , anytin fit happun.

My players for dey in danger. Dat kain tin no suppose happun netween two broda kontris."

Di Confederation of African Football president Patrice Motsepe tok say na di bodi "duty" to Senegal to make sure say dia federation get "all di support and encouragement wey dem need".

Sadio Mane last Afcon?

But Thiaw focus na on Sadio Mane as e tok say e hope say Sunday finals no go be di last game Sadio Mane go eva play for di tournament.

Mane na Senegal all time lead goalscorer wit 52 goals for 123 appearances.

Dis na afta e bin tell tori pipo afta di semi finals wia e beat Egypt say e no go wan play for anoda Afcon.

Thiaw tok say "I tink say e just decide for heat of di moment but di kontri no gree and me as coach no gree at all at all. No be just am get im decision, na all di pipo wey dey im back and we go like make e continue. We go like keep am for as long as we fit".

For di 2027 Afcon, dem don pick Kenya, Tanzania and Uganda to host am even though dem neva announce dates for wen e go hold as even dis Afcon go make am di first time for dia history wey di games go crossover to di new year.