You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
High-speed train collision kill at least 39 pipo for Spain
- Author, Harry Sekulich
- Role, BBC News
- Author, Guy Hedgecoe
- Role, Madrid
- Author, Rachel Hagan
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
At least 39 pipo don die for train collision wey happun for southern Spain, dozens don dey injure in di kontri worst rail crash for more dan ten years, acccording to Spain Civil Guard.
Carriages on di train wey dey go Madrid fall off track, crash wit train wey dey come for Adamuz, near Córdoba city.
Four hundred passengers and staff dey inside di two trains, di rail networks tok.
Dem don rush at least 73 pipo go hospital - 24 of dem don get serious injury, including four pikin - according to Andalusia emergency services.
Spanish Transport Minister Óscar Puente tok say di incident dey "extremely strange" as officials don start investigation.
All di railway experts wey govment consult, dey really "baffled by di accident," Puente tell tori pipo for Madrid.
Rail network operator Adif tok say di collision happun about ten minutes afta di train leave Málaga at 18:40 local time (17:40 GMT) as e dey go to Madrid, afta e derail for straight track.
Di force of di crash push di carriages of di second train into embankment, Puente tok.
E add say most of di pipo wey die and injure dey for di front carriages of di second train, wey dey travel from Madrid to Huelva.
Di type of train wey dey involve in di crash na Freccia 1000, wey fit reach top speed of 400 km/h (250 mph), one tok-tok pesin for di Italian rail company Ferrovie dello Stato tell di Reuters news agency.
Rescue teams tok say di twisted wreckage of di trains make am hard to recover pipo wey dey trap inside di carriages.
Córdoba fire chief Francisco Carmona tell Spanish public broadcaster RTVE: "We don even remove one pesin wey die so we go fit reach di pesin wey dey alive. E hard, na tricky work."
Salvador Jimenez, journalist wey dey work with RTVE and wey dey inside one of di trains, tok say di impact feel like "earthquake".
"I dey inside di first coach. One moment e be like say earthquake happen, and na so di train really derail," Jimenez tok.
Video wey pipo record for di scene show say some of di train coaches tip over lie for one side. Rescue workers fit dey climb di train dey pull pipo comot through di train doors and windows wey don bend.
One passenger wey dey go Madrid, José, tell public broadcaster Canal Sur say, "People dey shout, dey scream, dey call for doctors."
All train services between Madrid and Andalusia stop afta di accident, and dem expect say e go remain closed all through Monday.
Iryo, one private train company wey run di journey from Málaga, tok say about 300 passengers dey inside di first train wey derail, while di second train – wey govment-owned company Renfe operate – get about 100 passengers.
Up till now, dem never know di official cause of di accident. According to di transport minister, investigation no go fit tok wetin really happun until at least one month.
Spain Prime Minister, Pedro Sánchez, tok say di kontri go pass through "one night of deep pain".
Di mayor of Adamuz, Rafael Moreno, wey be among di first pipo wey reach di accident scene, describe di situation as "one nightmare".
King Felipe VI and Queen Letizia talk say dem dey follow di news of di disaster "with serious concern".
"We send our deepest condolences to di families and loved ones of pipo wey die, and we send love and quick recovery wishes to all di pipo wey injure," di royal palace tok for X.
Emergency agency for Andalusia region beg survivors of di crash make dem contact dia families or post for social media say dem dey alive.
Dem set up advanced medical points to treat injured passengers and move dem go hospital. Adif tok say dem don also arrange special places for families of victims for Atocha, Seville, Córdoba, Málaga and Huelva train stations.
Spanish Red Cross don send emergency support teams go di accident scene, and dem dey also give counselling to families wey dey nearby.
Miguel Ángel Rodríguez from di Red Cross tell RNE radio say: "Di families dey pass through serious anxiety bicos dem no get enough information. Dis na very stressful and painful moments for dem."
French President Emmanuel Macron, Italian Prime Minister Giorgia Meloni and di head of European Commission, Ursula von der Leyen, don release statements to show sympathy and condolence.
"My mind dey wit di victims, dia families and all di pipo of Spain. France dey stand wit una," Macron write for social media.
For 2013, Spain experience im worst high-speed train derailment for Galicia, north-west Spain, wey kill 80 pipo and injure 140 odas.
Spain get di second biggest high-speed rail network for di world after China. Di rail line dey connect more than 50 cities across di kontri, and Adif data show say di Spanish rail network long pass 4,000km (2,485 miles).