IGP order arrest of Seun Kuti over alleged police assault - Wetin we sabi

Seun Kuti

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Jelilat Olawale
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin

Di Inspector General of police don call for di arrest of Nigerian Afrobeat singer, Seun Kuti over alleged assault of police officer.

IGP Usman Alkali Baba direct di commissioner of police for Lagos state to sharparly arrest di musician after one viral video show am wia im dey assault one police officer.

Seun, 40, son of lengendary activist and musician Fela Kuti inside di video slap di officer wey dey in uniform while pipo watch inside dia moto.

Inside statement on Sunday night, di oga kpatakpata of police for Nigeria ''order speedy and full investigate into di remote and immediate cause(s) of di assault and prosecution of di suspect accordingly.''

E no dey clear wetin cause di wahala but Oga Kuti for one Instagram post claim say di officer bin wan ''kill me and my family''.

Na serious offence to assault police officer for Nigeria, but police assault by civilians dey happun well-well.

Many believe say na becos di pipo too dey experience police brutality too much for di West African kontri, na wetin fit don cause am. Such trend na im lead to di famous EndSars protest of 2020 wen plenti youths for many days carry waka enter streets all over di nation in protest against di actions of di men in uniform.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

'I get proof... e try to kill me and my family'

Di Afrobeat singer as di video begin dey trend on all social media platform enter im Instagram story to share im own side of di tori.

Oga Kuti inside di post allege say di officer wey video show as im dey slap am bin ''try to kill me and my family''.

E add further say e get evidence of wetin happun but say e ''no dey chase clout''.

Di middle-aged singer also say di officer in question don already tok sorry for wetin happun and ''I don agree not to press charges''.

''Make una mind una business make di poor guy no lose im job,'' Kuti tok.

Di singer also say e dey ready to cooperate wit di police for di investigation.

''I welcome di investigate and go give my full cooperation,'' e tok for Instagram.

Di action of di controversial singer don attract wide condemnation from Nigerians across di kontri as many describe wetin dem watch as ''unacceptable, lawless''.

'Na three years jail term' - Falana

Ogbonge lawyer and Senior Advocate of Nigeria Femi Falana for one statement wey im release also advise civilians against assaulting police officers sake of say na disrespect to di nation and e dey inside criminal laws.

"Even if policeman on uniform slap civilian, di civilian no get right to retaliate," Falana tok.

Falana also note say na three years imprisonment dey wait for anybodi wey dem find guilty say im assault police officer.

Di lawyer, however, tok say police officers equally dey advised to respect civilians.

Im say citizens fundamental right to dignity dey protected by section 34 of di Nigerian Constitution.

Falana say under di Anti-Torture Act of 2017, di penalty for assaulting civilians na 25 years imprisonment.

Im say no citizen gaz dey subjected to any mental, physical or psychological torture.

Di lawyer say both di Administrators of Criminal Justice Act, 2015 and Police Establishment Act 2020 don stop police officers and oda law enforcement personnel from subjecting Nigerian pipo, including criminal suspects to degrading, humiliating or inhumane treatment.

“Indeed, section (2)(b) of di Anti Torture Act, 2017 tok say torture don dey committed wen dem intentionally inflict act wey cause pain and suffering on pesin, weda e dey physical or mental to punish am for act wey im or anoda pesin commit or allegedly commit. Di penalty for assaulting civilian na 25 years under di Anti Torture Act of 2017," di statement add.