Ten die for Kenya as protesters close down central Nairobi

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Ian Wafula & Basillioh Rukanga
- Role, BBC News, Nairobi
- Read am in 6 mins
Ten pipo don die in during for Kenya protests, according to state-run human rights body.
Police open fire on demonstrators and earlier on Dr Aron Sikuku, one medic for Eagle Nursing Home in Kangemi on di outskirts of Nairobi, tell di BBC say dem don carry two deadi body to di facility and e die from gunshot wounds.
E tok say hundreds of protesters don gada outside di hospital as dem dey demand to take away di deadi body dem.
For one report, di state-run Kenya National Commission on Human Rights (KHRC) accuse di police say dem dey use excessive force.
"Police operate in plainclothes and unmarked vehicles" on Monday and collaborate wit "armed criminal gangs in Nairobi, Kajiado, Nakuru, Kiambu, and Eldoret", e tok.
Di demonstrations mark di 35th anniversary of di historic Saba Saba (7 July 1990) protests wey launch Kenya push for multiparty democracy.
From early morning, security forces don block all major roads into central Nairobi ahead of di protests. No body dey di city centre, as businesses shut down and heavy police presence dey on di streets.
Fights bin break out in oda places for Nairobi, as demonstrators light fires and attempt to attack police officers. Officers respond wit tear gas and water cannon.
Di police fire tear gas to scata pipo on Thika Road, as well as in Kitengela, one town on di outskirts of di capital. For Kamukunji, near di venue wia di original Saba Saba protests hold, police battle groups of protesters wey light fires on di streets.
Di rest of di kontri dey quiet, although dem report some clashes.
Earlier, hundreds of early-morning commuters and overnight travellers dey stranded at checkpoints, some more dan 10km (six miles) from di city centre, na only few vehicles dem allow make e pass.
Within di city, roads wey dey lead to key goment sites - including di president official residence, State House, and di Kenyan parliament - dem barricade am wit razor wire.
Some schools advise students make dem stay at home.
By mid-morning on Monday, hundreds of overnight passengers remain stranded outside di city centre, as major roads still dey closed.
Dem park some long-distance buses in Kabete, about 13km from di city centre, wit many passengers wey no fit afford to pay extra money for motorcycle rides to dia destinations as dem remain dia.
Humphrey Gumbishi, one bus driver, tok say im start im journey on Sunday evening dem im discover say police don block road in di morning.
"We begin travel around 8:30pm last night... We want di goment make dem tok to di Gen Zs so all dis fit come to an end," e tell di BBC

Wia dis foto come from, Anthony Irungu / BBC

Wia dis foto come from, Anthony Irungu / BBC
Inside one statement wey police issue on Sunday evening, di police tok say dia constitutional duty na to protect lives and property while maintaining public order.
Monday demonstrations wey Gen-Z young pipo organize, dey demand for good governance, greater accountability, and justice for victims of police brutality, continuing di wave of anti-government protests since last year.
On 25 June, at least 19 pipo die and dem loot thousands of businesses and destroy houses for one nationwide protests wey hold in honour of pipo wey die in last year anti-tax protests.
Recent demonstrations don turn violent, wit reports of infiltration by "goons", wey dem dey accuse of looting and attacking protesters. Civil society groups don allege say di fight betwin dis groups and di police - accusations say di police don strongly denied.
On Sunday, one armed gang attack di headquarters of one human rights NGO in Nairobi. Di Kenya Human Rights Commission (KHRC) don dey host press conference organise by women wey dey call for an end to state violence ahead of Monday protests.
Di KHRC tok-tok pesin, Ernest Cornel, tok say di gang make up for at least 25 pipo wey dey shout ontop motorbikes: "Protest no go dey today".
"Dem carry stones, dem carry clubs… laptops, phone and oda valuable wey dem steal from protesters and journalists wey dey dia" e tell di BBC Newsday programme.
Di original Saba Saba protests na key moment wey start multiparty system in Kenya democracy afta years of one-party rule.
Di response by di then goment under President Daniel arap Moi dey brutal. Dem arrest many protesters, while at least 20 pipo die.
Since den, Saba Saba don symbolise as civic resistance and di fight for democratic freedom for Kenya.
Raila Odinga call for national dialogue to reshape Kenyan police

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenyan former Prime Minister, Raila Odinga, don call for di reform of police to rebuild trust between di public and law enforcement.
During one interview for Nairobi hotel, he propose for urgent national dialogue to reshape di police force into true "pipo defender ".
"We get rogue police force wey dey shoot pipo wit impunity, force inherited from di colonialists," e tok.
Raila na figure in di historic July 7th demonstrations - wey pipo sabia as Saba Saba - wey challenge President Daniel arap Moi's one-party rule and call for multi-party democracy.
Saba Saba na symbol of civic resistance and di ongoing fight for democratic freedoms for Kenya.
Earlier, Raila don ask protesters make dem gada at Kamukunji Grounds in Nairobi on Monday for di 35th anniversary of pipo wey bin protest. However, police block all di roads wey dey lead into di capital.
"As living architect of di events wey lead to Saba Saba, I choose make minds come togeda in di interest of di kontri. I long fight for di progress, stability and prosperity," e tok.
Raila add say di most important struggle in Kenya today na di "struggle for good governance, economic opportunity, and equality," while e dey call for an end to corruption across all government arms.










