Attacks wey don happun since Tinubu declare national security emergency, how military dey respond

Nigerian security forces wey dey fight Boko Haram insurgency for Sambisa Forest, Maiduguri, Borno State

Wia dis foto come from, AUDU MARTE/AFP via Getty Images

Read am in 5 mins

For inside di same week wen Nigeria President, Bola Tinubu, declare security emergency, plenty more violent attacks bin happun for across di kontri in spite of govment announcement.

Nigeria dey go through veri tough period of insecurity especially for di northern region of di kontri wia jaguda pipo don attack schools, churches, and even ordinary pipo wey dey work for dia farms.

Bifor di security emergency declaration by Presido Tinubu, terrorists wey pipo believe say na members of di Islamic State for West Africa Province (Iswap) ambush and kill some Nigeria Army pipo including one Brigadier General Musa Uba.

Den for Kwara State, bandits attack one Christ Apostolic Church and kidnap more dan 30 pipo.

For Kebbi State, bandits also attack one Govment Girls Secondary School and kidnap 25 schoolgirls, and for Niger State, more dan 200 students and dia teachers bin dey abducted from St Mary's Catholic School Papiri.

Govment later announce say dem don secure di release of di Kwara worshippers and di Kebbi schoolgirls, but di Niger State students still dey miss reach today; di Catholic Bishop of Kotangora wey be di proprietor of di school tell BBC say govment neva make any meaningful attempt to rescue dem.

Na almost one week now since di govment declare security emergency and Tinubu, among oda tins, give di Department of State Services power to "to flush terrorists and bandits wey dey hide for our forests comot".

Howeva, e be like say di attacks neva slow down. Here na some of dem:

Kogi Church attack - November 29

Jaguda pipo attack one Cherubim and Seraphim Church for Ejiba community, for Yagba West Local Govment Area of Kogi State as dem dey do dia Sunday service.

Di attackers start to dey shoot anyhow as fear catch di congregation and many of dem scatter as di bandits pack pipo enter bush including di pastor of di church and im wife.

E neva dey clear exactly di number of pipo wey dey kidnapped for dat attack

Di Kogi State govment confam di attack and tok say dem don increase surveillance and manhunt against di bandits.

Commissioner for Information and Communication for di state, Kingsley Fanwo, say dem dey work hard wit security pipo to rescue di pipo wey dem kidnap.

‎"Di Guvnor of di State dey coordinate di activities, and we go dey keep di press updated on di operations," oga Fanwo tok.

Also, di State govment tok say ‎‎"worship centres for di outskirts suppose to reconsider worshipping for crime-prone areas for now until di situation get beta".

Bwari attack, FCT - November 26

Bandits attack Gidan-Bijimi community for Bwari Area Council of di Federal Capital Territory and kidnap seven pipo - six girls and one boy, according to weti di residents tell loca TV station Arise News.

Di tori pipo quote one Suleiman Shuaibu, who be relative to one of di girls wey dem kidnapp, and e tok say di six girls dey betwin 17 and 23 years old while di boy dey 16 years.

Di eye witness say di attack happun around 10pm of Wenseday, 26 November, 2025, as di bandits start to dey shoot gun anyhow for air, even di local vigilante pipo wey dey work for di area bin run for dia life sake of di kind of weapon wey di attackers bi carry.

Dis na in spite of di ogbonge security operation - Operation Sweep - wey di FCT Minister Nyesom Wike bin announce two days earlier wia e direct di police and oda security pipo make dem increase dia surveillance to stop crime and make sure say residents of di city dey safe.

24 Farmers kidnap for Niger State - November 26

Jaguda pipo carry out attack for Palaita community, for Shiroro Local Council Area of Niger State, wia dem pack 24 people folo bodi, including some pregnant women.

Dis attack happun for di middle of di day, around 2pm for afternoon wen di pipo bin dey work for one rice farm.

Survivors tell Channels TV say even though dia community dey close to anoda community - Erena - wia military base dey, di bandits still dey able to escape wit di pipo wey dem bin kidnap.

Niger State police later confirm di attack for one statement wey dem release, but dem say na only about 10 pipo dey kidnapped.

Successes by Nigeria Security

Also, since di declaration of di security emergency by Nigeria President Tinubu, di Nigeria Armed Forces say dem don record some successes for dia battle against insecurity across di kontri.

On Saturday, 29 November 2025, di Nigeria Army say dem scatter wetin for be ogbonge attack by more dan 300 terrorists for Chibok communities around almost 3am.

"Di troops bin dey alert and dem detect early enemy movement, and dis help dem to quickly assume battle positions and engage di terrorists from multiple fronts," di army statement tok.

"Di ogbonge firefight bin last for ova two hours and di gallant soldiers hold dia ground firmly and prevent di terrorists from breaching di security of di adjoining towns."

Howeva, di statement no metion weda di army kill any of di terrorists or weda dem seize any weapon from dem.

Again, on Sunday, 30 November, di army say dem rescue seven pipo wey bandits bin kidnap from Yankamaye Cikin Gari village for Tsanyawa Local Govment Area of Katsina State.

Babatunde Zubairu wey be one of di tok-tok pesin for di Nigeria army, write for statement say di bandits bin don kpai one old woman bifor dem kidnap di victims, and even as security forces rescue seven of dem, four stil dey for di hands of di kidnappers wey dey on di run.

"Di bandits bin run towards Kankia LGA for Katsina State and efforts dey ongoing to track dia location," oga Zubairu write.

Anoda success na di successful rescue of about 12 teenage girls for di Askira Uba area of Borno State on Saturday, 29 November.

"Di victims, wey dia age na betwin 15 and 20, bin dey kidnapped on 23 November as dem dey harvest crops for dia family farmlands ," di army tok.